We neva solve all di problem but we don lay better foundation - Tinubu

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don assure Nigerians to build kontri wey go work for di citizens.
For one nationwide broadcast to mark di third anniversary since e bicom di President, Oga Tinubu admit say im administration neva solve all di kontri problem finish, and things neva dey as e suppose be, but dem don lay di foundation for progress.
E say di work wey dey bifor dem dey clear now and dem wan ensure say di benefits of all di reforms wey di govment dey do go benefit ordinary Nigerians.
"We neva solve all di problem, and we neva reach wia we wan be. But we don lay di foundation for recovery. Di work bifor us now dey clear: we must ensure ordinary Nigerians feek di benefits of reform more directly for dia daily lives."
Di Nigerian leader say dem go continue to ensure say di prices of food wey don come down since 2023/2024 go remain low.
E also say dem dey work to reduce money for transport as operators of commercial trucks, buses, and taxis dey convert dia petrol engines to CNG and switch to electric vehicles.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Difficult but necessary decisions
For di statement to mark di end of im third year as president, Oga Tinubu, wey dey seek re-election, also highlight some of di achievements of im administration.
E say wen im administration enta office, evritin worse for di kontri, economic, security, unemployment, evritin bad.
"Our nation dey face economic and structural difficulties. Mounting fiscal pressures, unsustainable fuel subsidies, declining revenues, exchange-rate distortions, rising debt-servicing costs, insecurity for several parts of di kontri, energy supply constraints, plus declining public confidence for institutions, evritin bin dey threaten our progress."
Oga Tinubu say Nigeria bin dey spend as much as 18.4 billion naira ($13 million) daily to sustain petrol subsidies—ova 4 trillion naira ($2.9 billion) for 2022 alone, resources wey dem for invest for roads, healthcare, education, housing, and critical infrastructure.
"Multiple exchange rate windows and forex arbitrage bin create massive distortions, as Nigeria dey lose more dan 8 trillion naira ($5.8 billion) ova three years to rent-seeking and speculative practices," e add.
But wen e come on board, dem bin take difficult but necessary decisions stabilise di economy and prevent a deeper national crisis. E say if to say dem no follow dat difficult road, di nation for don suffer serious poverty and evritin for don scata.
"These decisions bin come wit sacrifice. Di rising cost of living go up by di measures we take and e place big pressure on families, workers, and businesses. Young pipo wey dey find work bin feel discouraged. Many question weda these difficult decisions go lead to better future."
Visible progress and economic growth
Oga Tinubu also highlight some of im administration success for education, health and security. According to am:
- Economy now dey more competitive and beta positioned for sustainable growth pass wetin e be for 2023. Public finances dey improve.
- Critical infrastructure projects dey advance at fast scale. Ova 2,700 kilometres of highways and major roads dey under construction, reconstruction, or rehabilitation, wey include di Lagos-Calabar Coastal Highway, di Sokoto-Badagry Superhighway, di Abuja-Kaduna-Zaria-Kano Road, among odas.
- Rail modernisation projects dey go on to improve connectivity, logistics, and economic integration across di federation.
- For di oil and gas sector, Tinubu say di reforms wey im administration bring don attract billions of dollars in fresh investment from di international oil companies wey bifor bin shun di kontri.
- Domestic gas utilisation dey expand. Local refining capacity don improve our energy security. Nigeria dey reduce dia dependence on imported petroleum products and conserving foreign exchange.
- For di power sector, Tinubu say im administration dey clear legacy obligations, expand transmission infrastructure, invest for renewable energy, and strengthening di national grid.
Security
Security na one serious challenge wey Nigeria still dey battle wit afta many years and several military interventions. In recent weeks, gunmen attack schools for di Borno and Oyo states, dem kidnap students, small children aged between 2 and 5, plus dia teachers.
Several attacks don also happun for churches and for different communities across di kontri wey don put fear for Nigerians body.
However, for im May 29 speech, President Tinubu assure Nigerians say im govment no go relent until evri Nigerian go fit live, work, travel, and dream in safety.
E say even though challenges still dey, many communities and highways don dey come bicom safer and more economically active.
"Our Armed Forces and security agencies don increase operations against terrorists, bandits, kidnappers, oil thieves, and criminal networks. We go continue dey invest in intelligence, surveillance, logistics, technology, and inter-agency coordination. We dey improve di capabilities of our armed forces and security agencies and reclaiming di authority of di Nigerian state wherever criminality dey threaten peace and order. While we continue to confront di challenges head-on, we dey make progress".










