US Supreme Court strike down Trump order wey limit birthright citizenship

Wia dis foto come from, SAUL LOEB / AFP via Getty Images
US Supreme Court don reject Donald Trump attempt to deny automatic citizenship to children wey born for di kontri to undocumented migrants.
Justices vote 6-3 opinion in favour of birthright citizenship.
Chief Justice John Roberts explain say di decision firmly reject di executive order wey Trump issue on di first day of im second term to stop citizenship for babies wey dem born for US to parents wey no be citizen or green card holders.
Di lower court don block di president order to stop federal agencies from issuing citizenship to children wey dem born for US soil if none of di parents be US citizen or lawful permanent resident (green-card holders.)
Di judgement on Tuesday go be di last judgment on di matta.
We dey update dis tori
We still dey update dis tori........






