Wetin South Africa authorities dey tok about June 30 anti-immigration protest

Published
Read am in 4 mins

Di June 30 deadline wey South Africans give for migrants wey dey tagged 'undocumented' to comot dia kontri don near and different security agencies including di South African Police Service dey on alert.

South Africa acting Minister of Police, Mr Firoz Cachalia dey meet wit Defence Minister, Angie Motshekga to discuss dia plans wey dem get ahead of di June 30 demonstrations.

Alreadi, South African President Cyril Ramaphosa say di kontri no go gree for illegal migration afta series of protests against foreign nationals don happun across di kontri bifor.

During im live address on Sunday 7 June, 2026, Ramaphosa say di kontri dey roll out different measures to curb illegal migration into South Africa.

All of dis na sake of South African claims say illegal migrants dey take dia jobs and say some foreign nationals dey no get documents to live for South Africa.

Sake of di different protests wey don take place bifor for South Africa, including harassment of foreign nationals- kontris like Ghana, Nigeria and Malawi don repatriate dia citizens comot for South Africa.

Wetin go happun for June 30 deadline

One of di groups wey dey call for protest for June 30, na March and March wey base for South Africa. Dem say dem dey fight illegal immigration.

For dia statement, di group among oda tins, say make President Ramaphosa address di kontri bifor June 30 and tok about di illegal migrants wey dey dia kontri. Ramaphosa don do dat one.

But di group no back down on dia June 30 deadline to foreign nationals wey dem say no get documents.

Dia plan na to occupy different streets and cities for South Africa to protest against foreign nationals wey dey undocumented.

"Na fight against illegal immigration, na fight against hostile takeova of our township economy, na fight against human traffic and fight against human theft."

Di group say dem no want violence during di protest and make pipo no come wit weapons.

Dem add say e better make illegal migrants begin dey self-deport dia sef back to dia kontri bifor di June 30 deadline.

"Our fight no be about to dey chase migrants from South Africa, na war against di exploitation of our pipo."

"We no want violence, we want stability for our kontri. We want make illegal immigrants self-deport dia sef."

During dat protest, South Africans ready to come up in large numbers to show dia grievances against wetin dem call undocumented migrants, action wey many pipo around di world dey watch to see how e go happun.

Alreadi, South Africa Department of Home Affairs say dem don block di identity documents of some citizens, and say make dem go present demsefs to officials.

Dem say dem don begin investigate di validity of some identity documents wey make dem block di IDs.

South Africa say if dose wey dey affected by di blocked IDs no take action, e fit lead to "possible permanent cancellation".

According to di notice by di Home Affairs, dem wan find out through dia investigation if di pipo wey dem block dia IDs na di true owner of di documents.

Wetin South Africa authorities dey tok about June 30

South Africa acting minister of police, Cachalia, tell local media for one event say di police dey prepare to deal wit di planned June 30 demonstration.

Di South Africa minister of police meet wit oda national commissioner as part of dia preparation for di day to dey peaceful.

According to local media DailyMaverick, dem quote wia di police minister say South Africans get di constitutional rights to protest, but no go allow any act of lawlessness or violence.

"Di operations dey aimed at ensuring say all foreign nationals wey dey reside for South Africa dey di kontri legally and get of valid documentation."

Oda di oda side, SouthA Africa Minister of Justice Mmamoloko Nkhensani Kubayi dey monitor di evacuation of some foreign nationals.

Di Justice minister dey part of di Inter-Ministerial Committee (IMC) on Migration, and dem monitor how some migrants comot for South Africa by buses.

Dem also visit di of KwaZulu, King Misuzulu kaZwelithini, for di Royal House wia dem go tok how govment dey make efforts to manage migration for di kontri.

Di acting Minister of Police, Cachalia dey do meeting wit Defence Minister, Motshekga ontop dis June 30 demonstrations, but di outcome of di meeting neva dey public.

Meanwhile, dem say na closed door meeting and media no go fit capture wey dey happun inside, but na until afta di meeting di minister go tok.