You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How angry mob surround police station, overpower officers and kill married woman
- Author, Abubakar Maccido
- Published
- Read am in 6 mins
Some angry youths kill one married woman and burn her alive afta dem forcefully carry her from police custody.
Di tragic incident happun afta rumours spread say di woman dey steal children for Maraban Jos, wey dey for Igabi Local Govment Area of Kaduna State.
Di incident, wey cause tension for di area, reportedly start bicos residents dey worry about alleged cases of child kidnapping for di community.
Reports tok say di woman bin dey go one religious preaching gathering wen some youths accuse her say she wan steal children.
Dem later carry her go one nearby police station for protection and investigation.
However, di situation later worsen wen hundreds of youths storm di police station dey demand make dem hand her over to dem.
Sources tok say di police fire warning shots for air to try stop di attack and restore law and order.
Di Kaduna State Police Command condemn di mob killing of di woman wey dem accuse of child theft for Maraban Jos on June 21, 2026.
For one statement, Police Public Relations Officer, DSP Mansir Hassan, tok say mob attack di woman over allegations of child theft.
According to di statement, police officers bin move di woman go di station for her safety and investigation.
However, di situation later escalate when, according to di police, "hundreds of pipo storm and surround di police station, overpower officers on duty, forcefully remove di woman from custody, kill am and burn her body."
Di victim na native of Maraban Jos.
Di Command describe di incident as "barbaric, criminal, and direct attack on di rule of law," and add say "no person or group get right to take law into dia own hands."
Di police also reveal say "dem don already arrest several suspects in connection wit di incident," while dem still dey hunt oda people wey involve.
"A full investigation don start, and all di culprits go face di full weight of di law," di statement add.
Di Commissioner of Police, CP Rabiu Muhammad, warn say di Command "no go tolerate jungle justice, mob action, or attacks on police stations and police personnel."
Timeline of mob cases for Nigeria
For March 2025 Tori be say di pipo wey die from di jungle justice bin dey travel through Uromi.
E neva clear how many pipo be victims of di mob attack however, plenty reports claim say dem be 16.
According to reports, di incident happun on Thursday, 27 March for Uromi, East North East local goment area of Edo state.
Tori be say di pipo wey die from di jungle justice bin dey travel through Uromi.
President Bola Tinubu for inside statement say dem be 'travelling hunters' while Govnor of Edo state call dem 'travellers'.
For September 2023 Police say dem find di deadibody of Fwimbe Thomas for ground in a pool of im own blood along Tudun Wada Ring Road, Hwolshe in Jos, North Central Nigeria around 10.30 pm for night.
Di family of di late Fwimbe Thomas wey mob beat to death wit sticks and stones for Jos, Plateau state, north central Nigeria dey call for justice.
Tori about di alleged mob attack wey lead to di death of Fiwimbe break for social media on Tuesday 26 September, 2023.
Fwimbe be just 35 years old.
Im describe wetin happun to im younger broda as "Jungle misbehaviour and not Jungle justice" sake of say notin like justice dey for di mata.
For July 2023 reports about one woman wey mob allegedly burn to death for Old Netim community, Akamkpa Local Goment Area of Cross River State, South -South Nigeria, go viral for social media.
Reports say angry mob burn Mrs Martina Okey Itagbor, wey dey 70 years, a mother of four children to death on 18 June, 2023, sake of accusation of witchcraft (Voodoo).
Now, di daughter of late Mrs Martina Itagbor don follow BBC Pidgin tok about wetin happun and how e be for her to lose her mama like dat.
For July 2023 one 32 year old man bin mob beat to death for Yenagoa, Bayelsa State say e allegedly steal bread dey known to be emotionally 'unstable'.
Dis na wetin some of di 32 year old Ebimotimi Freeborn Opuofoni relatives and neighbours tok about am.
BBC Pidgin find out say no be a loaf of bread e allegedly toff as tori bin cari but na bag of 'madiga', wey be a by-product from bread.
'Madiga' na one local delicacy from bakeries wey dey like bread but e hard pass am small and dem dey serve am snacks for small children and adults alike wey dem dey chop wit butter or eat alone.
Police for Bayelsa State don arrest three suspects wey allegedly participate in di killing of di 32-year-old man.
For February 2023 di family of Inuwa Sumaila family dey experience di kain pain wey dem neva feel before afta mob gather kill one of dia own unto accuse say e thief motorcyle.
Di family wey dey stay Sumaila local goment for Kano state wey dey north west Nigeria at di moment dey pursue justice for dia pikin.
Di victim 25-year-old Yahaya Inuwa na young man wey dey look forward to di future as e dey even plan to marry soon but im whole dreams for life end on January 17 2023.
For June 2022 Nigeria police don confam di murder and setting ablaze of local vigilante for di kontri capital, Abuja on Saturday 4 June 2022.
Di Police for inside statement say mob allegedly kill 30-years-old Ahmad Usman on allegations say im commit Blasphemy.
Dem add say di local vigilante member bin get into argument wit cleric around Tippa garage area of Abuja. Di argument according to di police turn heated argument wit one unnamed Cleric wey come lead to di murder and setting ablaze of Usman by angry mob wey reach about two hundred.
For 13 May 2022 Video of di killing of Deborah Samuel for alleged blasphemy inside Sokoto don provoke condemnation across Nigeria.
"Di mob wey descend on di female student also go on a rampage destroying property including vehicles as well as blocking a major highway."
Na wetin Police tok as dem launch full investigation into wetin happun.
Dis na full tori of how dem kill Deborah inside Shehu Shagari College of Education for alleged blasphemy.
Sokoto state close down di tertiary institution indefinitely afta di student death on Thursday.
For 2022, Police don arrest some suspects wey allegedly get hand for di mob action wey lead to di lynching and killing of one musical instrumentalist wey pipo know as David for Lagos.
Na three young men suffer di mob action but na one of dem die while odas escape wit life threatening injuries.
Video wey don circulate for social media show how di mob lynch di young men and set one of dem on fire.
A group of motorcycle riders na dem allegedly attack di men sake of argument over N100 (one hundred naira).