First batch of Ghanaians wey comot from South Africa sake of xenophobic attacks don land for Accra

Group of pipo coming down from airplane
    • Author, Mayeni Jones
    • Reporting from, Johannesburg
  • Published
  • Read am in 4 mins

Nearly 300 Ghanaians, including women and children, wey di govment help to comot from South Africa don arrive for Accra.

Dem be part of di ova 1000 pipo wey bin express interest to return home sake of anti-immigration protests for South Africa wey bin call for undocumented immigrants to leave by 30th June.

Ghana Foreign Affairs minister Samuel Okudzeto Ablakwa and oda govment officials bin receive dem for di airport.

Di 297 Ghanaians arrive onboard one chartered flight wey di govment arrange.

Men, women and children of all ages dey among dem.

Dis action dey come afta wave of protests against illegal immigration for South African cities in recent weeks, wey don lead to fears say e fit spark xenophobic violence for di kontri.

All the passengers dey registered by embassy and airport staff.

Ahead of im arrival, Rudolph, wey don stay for South Africa for 10 years and wey get salon wey e dey manage, tell BBC say im dey leave sake of di recent protests.

"E no dey comfortable for us to stay here anymore, so we gatz go. I tink we go find peace for house," e tok.

Wetin we call dis Video, 'We go find peace for house': Di Ghanaians wey dey comot from South Africa

About 25,000 Ghanaians dey live for South Africa.

Demonstrators say illegal migrants dey put pressure on public services and don ask South African govment to do more to stop am.

Na one group wey di name na March and March bin organise di demonstrations. Di group describe diasef as a citizen-led movement for immigration reform.

Dem set 30 June as deadline for illegal immigrants to comot di kontri. Rudolph worry say di deadline fit lead to violence.

"Di protests start for Durban, and don escalate go oda provinces. So e dey sure say somtin bad fit happun."

E add say im no go eva return to South Africa.

Ghanaian High Commissioner Benjamin Quashie tell BBC say im go ensure say di kontri citizens dey safe.

"Di Ghanaian govment don listen to di plight of dia citizens for South Africa, wey feel say dia lives dey for danger, wey feel say di economic activity dem dey do no pay again, wey feel unwelcome for dis kontri, and na di responsibility of evri govment to ensure say dia citizens dey taken care of both home and abroad."

Civil society marches for Durban for stricter immigration enforcement, South Africa - 06 May 2026

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Some link anti-migrant marches to local elections due to take place later dis year

Wen tori pipo ask wetin Ghana officials dey do to ensure say illegal migrants from Ghana no enta South Africa, e say dem get reintegration strategy in place for dose wey dey return.

"Di govment ready to establish dem for whatever business dem bin dey do for South Africa. In a way, we also dey help di South African economy, bicos e dey clear say some of dem dey undocumented.

"So taking dem out of here go let dem know say we no be pipo wey dey permit undocumented pipo for kontris."

Some analysts suggest say di resurgence of anti-migrant sentiment for South Africa fit dey linked to local elections scheduled for November.

For 2019, rioters kill at least 12 pipo and for 2008, 62 foreign nationals die inside attacks on foreigners across di kontri.

But di organisers of recent protests say e dey peaceful.

Earlier dis month, di South African govment condemn criminal acts directed at foreigners, as dem add say di kontri need to deal with illegal immigration.

Fotos of di Ghanaians wey arrive today

Ghanaians from South Africa
Ghanaians from South Africa
Ghanaians from South Africa
Ghanaians from South Africa