Five key lessons Inec mock accreditation exercise reveal ahead of 2027 general election

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don test dia electoral technology and operational readiness ahead of di 2027 general elections through one nationwide mock accreditation and voting exercise.
Di exercise, wey dem carry out on Saturday, 28 November across selected polling units across di kontri na to assess di how di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS) take dey function, test accreditation procedures and to know how prepared di commission dey for di forthcoming general elections.
BBC News bin cover some polling units across Lagos, FCT, Kano, Oyo, states among odas and report say di exercise record low voter turnout for some areas, electoral officials and materials no reach some polling units early, lack of communication between di commission and di voters, also some polling units experience technical challenges wey affect di accreditation process.
Dis na some of di lessons from di exercise.
Low turnout across several states
Low participation of voters for several locations, wey include Lagos, FCT, Oyo, Anambra, among odas.
For Polling Unit 002, Holy Cross Ward D3, Popo Aguda, voter turnout no really encourage, even though Inec officials arrive and start di process early.
For Polling Unit 001, Ward 12, Popi Aguda, INEC officials arrive, but voter participation still remain low.
However, di situation dey different for Kano state, as di turnout of voters dey high but most of dem tink say na di election proper, as dem dey request wia di political parties dem wan vote dey.
















