'No allow concerns for illegal migration lead to hatred for fellow Africans' - Cyril Ramaphosa

Wia dis foto come from, Getty Images
President Cyril Ramaphosa don condemn di recent xenophobic attacks, wey see some South Africans attack black Africans and destroy dia businesses for di kontri.
Di South African leader during di 2026 National Freedom Day celebration wey hold for Bloemfontein on Monday, 27 April, caution im kontri pipo say make dem no allow dia legitimate concerns about illegal migration lead to hatreds towards fellow Africans.
E say although South Africans dey concerned about undocumented and illegal migrants for di kontri, make dem however, no allow dis concerns lead to xenophobia.
"Make we no allow dis concerns give rise to xenophobia, directed towards pipo from oda African kontris or any oda parts of di world.
"We as South Africans no fit allow hatred towards odas drive us, odas give us compassion, dem give us support, we no fit dey driven by hatred towards dem", President Ramaphosa add.
Di South African leader comment dey come afta some recent video clips wey go viral online show as vigilante groups dey attack and confront pipo dem believe say dey stay for South Africa illegally. For inside one of di videos, dem challenge one Ghanaian man ova im status.
Also, last week, Ghana bin summon South Africa top envoy to di kontri ova reported "acts of intimidation and harassment" against dia citizens and oda African migrants for di southern African nation.
Also, Nigeria govment say di Ministry of Foreign Affairs don dey engage wit di South Africa govment on top di mata.
NIDCOM Chairman, Abike Dabiri wey give di informate say, "Africa Union gatz intervene for dis dastardly xenophobic attacks against blacks for South Africa".
Xenophobia for long don be issue for South Africa and dey occasionally lead to outbursts of deadly violence.
Ghanaian officials don meet di man for di video to offer am support and also urge citizens wey dey live abroad to continue to dey "law-abiding".
Meanwhile, President Ramaphosa don tok say im govment dey clamp down on illegal migration and on businesses wey dey disobey di laws of di kontri by hiring undocumented pipo instead of dia citizens.
"We dey actively root out corruption for our immigration system."
For im address, e also advice foreigners wey dey dia kontri legally to respect di laws and traditions of dia nations, as dem go want make dem also respect di laws and traditions of dia own kontri.
"We extend hospitality to pipo wey be guests for our kontri, wit di expectation say dem honour our generosity wit respect for our society and dia laws."
E add say dem don already put in place measure wey dem go take deal wit pipo wey dey dia kontri illegally.
As reports of renewed anti-foreigners protests bin spread for some parts of di kontri, Nigeria govment issue advisory to dia citizens wey dey live for South Africa to exercise caution.
For one statement on Friday, di Nigerians in Diaspora Commission (Nidcom) say demonstrations for several cities - including Cape Town, Durban and East London, now known as KuGompo City - don turn violent, wit reports on incidents of looting, damage to property and injuries.
Ghana Foreign Affairs Ministry say dia officials don also meet South Africa acting high commissioner to Ghana, Thando Dalamba, and don raise formal protest ontop di recent "xenophobic incidents" against foreigners, including dia citizens.
South Africa na home to about 2.4 million migrants, just less dan 4% of di population, according to official figures. However, belief dey say many more dey di kontri unofficially.
Most of dem come from neighbouring kontris like Lesotho, Zimbabwe and Mozambique, wey get history of providing migrant labour to dia wealthy neighbour. Small number come from Nigeria.
Vigilante groups like Operation Dudula, wey mean to force out for di Zulu language, and March on March claim say migrants don full South Africa and dem blame di migrants for many of di kontri social problems, especially unemployment and drug abuse.
Dem don hold demonstrations for major cities wey sometimes turn violent and result in attacks on foreign-owned shops.
Earlier dis week, March on March bin lead one protest for di port city of Durban and inside one clip wey spread on social media, e show as some of di participants bin seriously dey attack one man dem believe say na illegal foreigner.










