Temi Otedola and Eazi welcome dia first pikin

Temi Otedola wear matching white cloth wit her husband wey show her baby bump as she rest for im body.

Wia dis foto come from, Temi Otedola/Instagram

Wetin we call dis foto, Foto of Temi Otedola and her husband Mr Eazi
Published
Read am in 2 mins

Actor, entrepreneur, and creative Temi Ajibade wey be di last daughter of Nigerian billionaire Femi Otedola don born pikin.

Temi wey be di wife of Oluwatosin Oluwole Ajibade wey dey popular as Mr Eazi announce di birth of dia pikin for her social media page.

She post on Thursday evening say "Before I form you inside womb I don already know you, Bifor dem born you I set you apart".

She make di post wit plenti foto wia she dey pose wit her baby bump.

Mr Eazi and Temi bin do dia ogbonge wedding for different kontris inside three continents.

And dis pikin na di first grand pikin of Nigeria businessman Femi Otedola.

Temi Otedola Ajibade siddon under tree , she wear white cloth wey dey show her baby bump.

Wia dis foto come from, Temi Ajibade Instagram

Wetin we call dis foto, Temi Otedola Ajibade

Di wedding wey nearly break internet hapun for Monaco, France on May 9, 2025 wia dem do di civil wedding.

Dem do Yoruba traditional marriage for Dubai, and di church wedding hapun for Iceland.

Nigerians and dia fans don dey send congratulatory message to di couple already.

Dem neva tok di gender of di pikin wey dem born yet.