Who be Pastor Dolapo Lawal wey Arsenal fans dey banter for social media

Wia dis foto come from, @thedolapolawal/Instagram
Di lead pastor of Zoe Household Global Church, Pastor Dolapo Lawal, don dey face backlash on social media afta im sermon wia e tok say Arsenal dey 'cursed' and dem no fit win Premier League title.
Dis statement don cause gbasgbos ontop internet as Arsenal fans begin drag di pastor on social media afta Arsenal win di Premier League.
Di English club win becos Manchester City draw wit AFC Bournemouth on Tuesday night bifor di final matches on Sunday.
Inside one viral sermon wen di pastor bin dey preach, e tok say Arsenal no fit win.
"Arsenal no fit win. I no tok am? You dey hia wen I tok am three months ago say even if dem get 29 points lead, Arsenal no fit win," di pastor tok.
"E get di way you go dey watch club, no be prophecy, dem dey cursed," e tok.
"And if you dey here, lady, if Arsenal fan ask you out, na bad sign. You need to go check yoursef say of all pipo, Arsenal?"
Dis don cause plenti kasala ontop social media, on Wednesday di pastor tender apology di supporters of Arsenal.
Di pastor release one video wia e invite di club supporters to im Church and e tok say di sermon na just joke and no be prophecy.
"Arsenal fans, special thanksgiving for you for Zoe Household on Sunday. Make you come wit your jersey, we go thank God for una. Dis na my apology, public apology, special thanksgiving service for all Zoe Household campuses. Praise God. Congrats," di pastor tok.
Inside anoda video, e tok say im wife, relative and friends dem be Arsenal supporters, e tok say im friend send am one video wia e begin see different perceptives and di sermon na just "joke"
"I just dey joke. I no dey curse Arsenal and God no tell me anytin about Arsenal. Na just normal banter wey I dey make wit Arsenal fans for my church," e tok.
Profile of Pastor Adedolapo Lawal
Dem born Pastor Dolapo Lawal for November 13, wey be di lead pastor for Zoe Household Global, wey dey for 320 Riverside Pkwy 100A, Austell, GA 30168, United States of America. E graduate from University of Lagos wit degree from Computer Science.
Adedolapo na prominent televangelist, songwriter, preacher and mentor wey dey use im platform preach sermon to Christian communities across di world.
E born two pikin wit im wife,Temiloluwa Lawal.
Pastor Dolapo na author of di book wey e publish, "Watchman's Prescription" (2021), wia e explore biblical insights on faith, prayer, and Christian living.
Di book reflect practical spiritual discipline while e maintain theological depth.
Pastor Lawal grow as Muslim bifor e convert to Christianity afta e gain admission into di University of Lagos.
E get some worship songs:
Song of the Redeemed
God of Heaven (2023)
Forever (2023)
Oba Wa (2023)
Without You (featuring Minister Folabi Nuel) – 2023
Amen Halleluyah (featuring Emeka Madubata) – 2023
Faith is Rising (2023)
Emi Mimo (2023)
Wonderful God (2023)
Captain of the Faith (featuring Jennipher) – 2023
Album: Yeshua (2023)










