Family members break into Ebola centre carry dead body run, patients escape for DR Congo

M23 soldiers provide security for di movement authorities for di Rodolphe Mérieux Laboratory, National Biomedical Research Institute (INRB) in Goma, on May 19, 2026 during dia guided visit to di laboratory responsible for analyzing and handling suspected Ebola cases

Wia dis foto come from, Jospin Mwisha / AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Health officials for di Democratic Republic of di Congo say kasala start for one Ebola treatment centre near di eastern city of Bunia afta family members of a suspected Ebola victim use force carry dia deadi body comot, despite warnings from medical staff.

During di kasala, six patients escape from di facility, including three wey get Ebola cases wey authorities don confam.

Dem also put fire for some parts of di Ebola treatment centre for Rwampara General Hospital.

E never clear whether anybody wunjure. Later, di military place medical workers under dia protection while police try to restore order.

Health experts warn say Ebola fir spread through contact wit di body of pesin wey don die di virus becos bodily fluids remain highly infectious afta death.

Di World Health Organization recommend say only trained burial teams wey wear protective equipment go handle Ebola victims.

Authorities for di Democratic Republic of Congo say di outbreak don cause 159 probable deaths from more dan 600 suspected cases.

Police neva comment on Thursday incident.

For anoda incident, DRC Congo cancel dia pre-World Cup training camp for Kinshasa, becos of di Ebola outbreak for di eastern part of di kontri.

DRC don shift dia preparations to Belgium, as di outbreak don cause di death of ova 130 pipo.

Di World Health Organization (WHO) tok say di outbreak na "public health emergency of international concern", but e neva reach pandemic level.

Jerry Kalemo, wey be di tok-tok pesin for di national football team, tell international media say di pre-tournament games for Europe go happun as dem dey prepare for dia first World Cup since 1974.

DR Congo go play friendly matches against Denmark, on 3 June for Belgium, and Chile, on 9 June in Spain, bifor di World Cup finals.

Dem go play dia first match for di tournament for Houston, US, on 17 June, against Portugal.

"Di training wey suppose take place for di capital on May 26, inside di Leopard public training session no go hold again. Dis decision na afta di reports of suspected Ebola cases for North Kivu and Ituri provinces,

How you fit prevent Ebola virus

Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.

No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.

Avoid deadi bodies

No dey kill, touch or chop bush meat

E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo. And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.

Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.

For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.