Justice Minister defend why more dan 600 terrorism suspects dey face mass trial

Di Federal Government don arraign anoda set of about 490 terrorism suspects for di Federal High Court for Abuja.
Dem arraign di suspects on Monday as mass trial kontinu for plenty of di suspects wey don dey for govment custody for many years.
According to di kontri Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, anoda 90 suspects go dey arraigned on Tuesday to bring di total numba for dis batch to almost 600.
Rememba say di govment bin also conduct. trials for more dan 500 terrorist suspects for April dis year, wia many of dem dey convicted and court sama dem different punishment, from three years to live in prison.
Govment sama different allegations against di suspects like taking part in terror attacks or supporting di insurgets by giving dem food, money, fuel, or information.
Oga Fagbemi tell tori pipo for court on Monday say dis exercise na to show say di present govment for Nigeria dey determined to fight terrorism and insecurity to standstill.
"We go fight wit every inch of our blood to make sure say we make Nigeria safe haven for evribodi. Di message dey clear, direct and straight forward, and e be say dis present administration no dey take di issue of terrorism wit levity," di AGF tok.
E add say dis na di fourth set of terror suspects wey di govment dey bring to court since dem come to power.
"Well, for dis phase; di ones we get today, we get about 490. Tomorrow we go get 84, but dis 84 no include di 102 wey we bring forward from di last phase. So in total, we get almost about 600 plus to contend wit for dis phase," Fagbemi tok.
Di Justice Minister tok say dem don get assurance by di judges wey dey handle di cases say dem go do dia part to make sure say dem clear di numbers for dis batch, and say di trial go meet evri standard of di rule of law.
About 10 judges don dey assigned to hear di dfferent. cases witin di timeframe, Fagbemi tok, and dem no go do any oda case apart from dis ones until dem finish dem.

So far, some of di suspects don dey convicted as some of dem plead guilty, oga Fagbemi tok, but di ministry of justice say dem go complie record of how all di mata take go and make di list available to tori pipo later.
Dis set of mass trial dey expected to last from dis Monday, 15 June, to Thursday, 18 June 2026.
Our tori pesin observe say all di oda mata wey suppose go on for almost all di courts for di Federal High Court dis Monday dey postponed.
Some of di judges wey dey handle dis mass trial include: Emeka Nwite, Binta Nyako, James Omotosho, Musa Liman, Ekerete Akpan, and Obiora Egwuatu, among odas.
Na about 58 terror suspects appear bifor Justice Nwite, according to di court list wey our tori pesin see.
Dis mass trial exercise also dey monitored by local and international human rights organisations and professional bodies like di National Human Rights Commission, Amnesty International, and di Nigeria Bar Association.
Some of dis human rights bodies bin don accuse Nigeria say dem dey use excuse of terrorism to illegally hold plenty young pipo for prison witout trial.
Terrorism for Nigeria don dey spread from di Northeast region of di kontri wia Boko Haram bin start to dey distrub more dan a decade ago to several oda parts of di kontri including di western region.
Last month, terrorists bin attack one school for Oyo State, for di southwest area of Nigeria and kidnap almost 40 pipo, including schoolchildren and dia teachers, bifor dem later kpai one of di teachers and share di video for social media.
Di victims still dey in captivity despite plenty promises by di federal and State govment to rescue dem.











