Teenager kpai im grandparents and odas for shooting wey injure many for Thailand

Wia dis foto come from, TNP/Arnun Chonmahatrakool/Thai News Pix/LightRocket via Getty Images
At least seven pipo don kpai for Thailand afta one teenage boy shoot im grandparents and some schoolteachers.
More dan 30 odas don injure and nine dey for serious condition, PM Anutin Charnvirakul tok.
Authorities say di suspected shooter, 14, don also kpai, as Charnvirakul tell reporters say di attack bin dey "well prepared" wit "clear steps and clear goals".
One student, wey run comot for di school for Nonthaburi for di outskirts of Thailand capital Bangkok, tell di BBC say she see one teacher wey e shoot.
Anoda student wey still dey wear her school uniform describe how she and some friends "gatz climb ova di school fence to escape".
Authorities don urge di public to stay away from di vicinity of Debsirin School - images show emergency responders for di scene.
Dis na di second school shooting for Thailand dis year - despite restrictions on ownership, pipo fit acquire guns dia wit ease.
Police investigate house wia di shooter allegedly kpai grandparents

Wia dis foto come from, Reuters
Bifor heading to di school for Nonthaburi, authorities say di 14-year-old suspect bon don shoot and kill im grandparents for dia house.
Images show police dey comb di scene as investigations continue into di motive behind di shooting.
A timeline of how di shooting unfold
- Just afta 10:00 local time (03:00 GMT): Shots dey reported from di Nonthaburi branch of di Debsirin School for di outskirts of di capital Bangkok.
- 10:27: Di situation dey active as Police Col Passakorn Chaitaweewong tell di BBC.
- 11:45: Di BBC confam from a police officer say di suspected shooter na 14 years old; local media report say e don kpai.
- 13:24: Reuters cite police wey say di gunman shoot and kpai im grandparents for dia house bifor e open fire for di school.
- 17:50: From one press conference wit Thailand Prime Minister Anutin Charnvirakul, e confam say eight pipo don kpai - di gunman, im grandparents, and five teachers. More dan 30 dey injured, wit nine in serious condition.

Wia dis foto come from, Reuters
'Bullets hit di floor': Eyewitnesses react to di shooting
Following di shooting for Debsirin School for Thailand capital Bangkok, teachers, pupils, and emergency workers for di scene don tok how e happun.
One 31-year-old teacher describe how e see pupils dey run and scream from one building at di oda end of di school, bifor dem later learn say one of dia friends don kpai.
One female student tell di BBC say she bin dey stand in front of one teacher wen e shoot dem, and explain how she escape by climbing ova di school fence.
One rescue worker describe how e find di suspected shooter wit a pulse, afta offering medical attention to students wit gunshot wounds.
One 17-year-old student say she fit "hear as bullets dey hit di floor" directly above her and "dey fear say I fit kpai".
Anoda student "no tink say na gun at first". E tell Reuters say e initially tink say di noise dey come from firecrackers bifor e hear "many shots: Bang bang bang".

Wia dis foto come from, Reuters
Students take shelter for classroom as dem hear gunshots
Footage don come out of students wey take shelter for one classroom togeda, as dem dey hear bangs wey sound like gunshots.
Di students dey seen as dem bend down under desks and chairs and reach out to each oda.
Di gunman kpai five teachers for di Debsirin Nonthaburi School, and many odas injure.
Second school shooting dis year dey raise questions on gun control - again
Tori be say e be like say di shooter bin dey target teachers. Di shooting bin dey go on for about one hour bifor di perpetrator, a 14-year-old student for di school, come turn di gun on imsef.
Di boyfriend of one of di teachers wey kpai dey veri distressed. "Dis no suppose happun," e tell tori pipo as e try to hold back im tears.
Di Debsirin Nonthaburi School dey located for a large, urban residential and commercial area to di north of Bangkok. A lot of pipo dey go from here to di capital, and dis na a veri well known school for dia, so dis incident go get serious effect on di community.
Dis na di second school shooting for Thailand dis year.

Wia dis foto come from, LILIAN SUWANRUMPHA/AFP VIA GETTY IMAGES
Thailand don see several deadly gun violence in recent years
Levels of gun crime dey relatively high for Thailand, wia gun ownership, both legal and illegal, dey widespread.
Di kontri don see several deadly incidents in recent years:
- 2026 school siege: For February police arrest one gunman afta two pipo - di school principal and one student - bin injure for one two-hour standoff inside one school near di city of Hat Yai.
- 2025 market shooting: Five pipo kpai for one mass shooting for Or Tor Kor Market for Bangkok. Di shooter take im own life, and police say im bin get disagreement wit market security guards bifor e happun.
- 2023 mall shooting: dem arrest one 14-year-old boy afta e kpai two and injure five odas for one mall for Bangkok.
- 2022 childcare centre attack: One former policeman kpai 37 pipo including 23 children, wen e storm one childcare centre for Thailand north east. Police kpai am after a manhunt.
- 2020 shopping centre shooting: Security forces kpai one soja afta e bin go on a gun rampage for di Thai city of Nakhon Ratchasima wey kpai 26 pipo and injure ova 50 odas. E bin don kpai im commanding officer bifor e steal weapons from one military camp.
Di real issue na say while restrictions on gun ownership dey for Thailand, pipo fit still get guns – legally or illegally – wit relative ease. Thailand get one of di highest rates of gun ownership for South East Asia.
Dem don raise questions about gun control bifor and e no dey clear if authorities don take any significant action to curb gun crime.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock
Debsirin Nonthaburi School call for blood donations
Di school wia di shooting happun, di Debsirin Nonthaburi School, don announce say all activities dey cancelled today and tomorrow due to di "emergency situation".
For one post on Facebook, dem also dey call for blood donations.
Di school na di local branch of di popular Debsirin School - a century-old educational institution for Bangkok. Di original Debsirin School also don express dia "deepest condolences for di loss" for one social media post.
Suspect na 'avid gamer' - deputy interior minister
Thailand deputy interior minister Polapee Suwanchawee don share further details on di suspect, including di fact say e be avid gamer, according to evidence wey police don gada from im house.
Di suspect, wey be 14-year-old student, bin dey live wit im grandparents, wey dem find dead at home.
Authorities believe say e kpai im grandparents bifor e go school, wia e shoot five teachers.
E kon shoot imsef and kpai on di way to hospital.
One teacher for di school say di boy na "good kid wit good study records", and dem no know am to dey aggressive.









