John Mahama reshuffle cabinet appoint, Kenneth Gilbert Adjei as defence minister

Wia dis foto come from, Felix Kwakye Ofosu/X, @zanetorofficial/X, National Development Planning Commission/Website,Ministry for Works, Housing and Water Resources/ Website.
President John Dramani Mahama don reshuffle im cabinet as e reappoint Kenneth Gilbert Adjei wey be minister of works, housing and water resources to become di minister of defence.
Minister of Local Government, Chieftaincy and Religious Affairs, Ahmed Ibrahim go move to ministry of works, housing and water resources.
While, Mahama nominate di majority leader, Mahama Ayariga to become di minister of local government, chieftaincy and religious affairs.
Anoda parlaiment member wey di president nominate na, Zanetor Agyemang-Rawlings - she go become minister of environment, science and technology.
Mahama appoint Adjei one year afta di former defence minister Edward Omane Boamah die for military helicopter crash wey crash near Adansi Akrofuom for Ashanti Region
Di president announce im decision inside one press statement on Thursday and e don submit di nomination lists to di kontri parliament through di Speaker make dem approve am.
Kenneth Gilbert Adjei wey bin dey serve as Minister for Works, Housing and Water Resources, go assume officer as Defence Ministry, to replace late Edward Omane Boamah wey die for inside one military helicopter crash for Adansi area of Ashanti Region on August 6, 2025.
Profile of Kenneth Gilbert Adjei

Wia dis foto come from, Ministry for Works, Housing and Water Resources/ Website
Kenneth Adjei bin serve as Ghana Deputy Minister of Defense from 2012 to 2017, wen John Mahama appoint am bifor e come reappoint am as di minister of works, housing and water resources for January 2025 .
Dem born am on September 20, 1978, den im obtain im Master of Arts in Peace, Security and Intelligence Management from University of Professional Studies (UPSA) for 2022.
Kenneth na proud member of old student association of Opoku Ware School and na from Trede, for Ashanti Region of Ghana.
For di past eight years, e bin work as researcher for defense strategies for im organisation. E gada experience in di finance and insurance industry, wey don give am expertise for risk management and strategic planning.
E obtain im executive MBA for marketing from University of Ghana Business School and Bachelor of Science Degree for Marketing from Ghana Institute of Management & Public Administration (GIMPA).
For di past one year, e work hard to build solid infrastructure, develop community partnerships, and ensure say works, housing and water resources for Ghana dey top priority. E also focus on sustainable development and dey commited to modernise water treatment and supply systems for di kontri, while e dey tackle challenges wey climate change and urbanization don bring.

Wia dis foto come from, National Development Planning Commission/Website
Ahmed Ibrahim na Ghana politician, dem born am for 6 May 1974, for Banda Ahenkro for Bono Region for Ghana.
Ibrahim study for University of Ghana wia e obtain bachelor degree for Political Science and Philosophy for 2001. E also get Master of Business Administration degree, wit specialization for Finance from di Ghana Institute of Management and Public Administration for 2019.
Ibrahim na di Chief Executive Officer of Flamingo Publications (Ghana) Limited.
Ibrahim statrt im political career for 2009 afta dem declare am winner for di 2008 General Elections for Tain constituency. Dem elect am into di 5th Parliament of di 4th Republic of Ghana on January 7, 2009. Afta im complete im first term, Ibrahim decide to run again for 2013 and im beat Joe Danquah to keep di seat.
Dem create new District (Banda) from Tain District, so Ahmed Ibrahim decide to contest under NDC ticket and e win di parliamentary primaries for Banda for 2015.
Also, for 2016 e win di parliamentary seat wit 6,167 votes about 52.03% of all di votes against im opponent wey get 5,660 votes about 47.76%.
Ibrahim win di 2024 election to be member of parliament for di 9th parliament under National Democratic Congress ticket.
Ahmed Ibrahim na di longest serving Deputy Chief Whip for di history of Parliament of Ghana, e hold dat position for three times back to back (from 6th to 8th Parliament of di 4th Republic).
Ibrahim na member of di Special Budget Committee, member of Communications Committee, member of Local Government and Rural Development Committee, and member of Business Committee.
Ahmed Ibrahim na Christian and e don marry wit one pikin.









