World oldest president Biya return to Cameroon afta more dan two months for abroad

Wia dis foto come from, Getty Images
Cameroon President Paul Biya don return to di kontri afta e spend more dan two months on a "private stay" for Geneva, Switzerland.
Di 93-year-old wey also be di world oldest head of state land di capital, Yaoundé, on Thursday evening, wit im wife Chantal Biya.
Dem broadcast im return live on di state media.
For di Yaoundé Nsimalen International Airport, hundreds of supporters from di ruling CPDM party bin gada to welcome am.
Dem wear fabric wey dem print Biya image on and di excited crowd dey hail am as dem dey chant and dance.
Di live media broadcast show as di president dey wave to im supporters from im car, without directly engaging wit dem.
Dem also show one moment wia e briefly greet state officials.
Biya don dey away since 7 June for one foreign trip wey im team initially describe as brief.
End of Di one wey oda users dey read well well
However, im prolonged absence bin raise speculation about im health — di govment deny claims say e dey hospitalised.
Meanwhile, e continue to sign decrees from abroad, wey include major reshuffle of di military leadership plus authorisation for di govment to secure loans from international financial institutions.
Throughout im more dan 70-day stay for Europe, di opposition and critics argue say di uncertainty wey surround di duration of Oga Biya trip abroad dey enough to declare im seat vacant by di constitutional council.
In response, di ruling CPDM tok say di president dey work from abroad and say constitutional limits no dey to di time wey di president fit stay out of di kontri.
Di veteran leader don often face criticism ova im numerous private foreign trips during im nearly 44-year reign.
Im return dey come afta di brilliant victory of di Indomitable Lionesses for di Women's Africa Cup of Nations for Morocco.
Di squad return home wit dia maiden Wafcon trophy on Monday, so e dey expected say di president go officially host dem.
E no dey clear if Biya for return home today if to say di women's football team bin lost for di final on Sunday.














