Ademola Adeleke win Osun State governorship election - Inec declare

Gov Ademola Adeleke

Wia dis foto come from, Gov Ademola Adeleke/Facebook

Published
Read am in 4 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Ademola Adeleke of di Accord party as winner of di Osun State govnorship election wey happun on Saturday, 15 August.

Adeleke bin contest di election wit 14 oda candidates including di candidate of di All Progressives Congress Bola Oyebamiji, wey be im closest rival.

Di Returning Officer for di election Professor Oluwatoyin Ogundipe, wey announce di results for di early hours of Sunday, 16 August, declare say Adeleke get total of 511,067 votes.

Oyebamiji of APC get 444,815.

Di EFCC say dem bin don dey investigate di Osun State account sake of say dem suspect some magomago wey dey go on.

Govnor Ademola Adeleke and im nephew David Adeleke alias Davido

Wia dis foto come from, Osun State Government

Wetin we call dis foto, Govnor Ademola Adeleke and im nephew David Adeleke alias Davido

For one statement wey e personally issue, President Tinubu say im feel "deeply embarrassed no be bicos EFCC exercise dia mandate wey dey backed by court order, but by di timing of di agency action".

Apart from di matter wey involve EFCC, oda issues including threat of violence from different political leaders also dominate di election.

Dis one make popular singer and Grammy nominee Davido raise alarm for social media.

Davido wey im real name na David Adeleke na nephew of di incumbent Osun state govnor Ademola Adeleke.

Di singer wey get millions of fans for di world use im social platforms call on US President Donald Trump to chook eye inside wetin dey happun for Osun state. E no clear if e get response or not.

Who be Ademola Adeleke?

Ademola Nurudeen Jackson Adeleke na di current govnor of Osun State wey just win re-election to lead di state for anoda four years.

Adeleke come to limelight for politics afta di death of im broda, Isiaka Adeleke, wey bin don serve as govnor and senator for di state.

Na afta Isiaka die for April 2017, na im di younger Adeleke contest to take im place for di Senate and e win.

Den for 2019, Ademola Adeleke run for im first govnorship election under di Peoples Democratic Party (PDP), but lose to Adegboyega Oyetola of di All Progressives Congress (APC).

E contest again for 2022 and win to bicom di second Adeleke to sit for di number one position for Osun State.

However, sake of di internal wahala for di PDP, di govnor comot from di party and join Accord party, wia e win re-election.

Adeleke get higher education for Jacksonville State University, Alabama, USA, wia e bin study Criminal Justice wit minor in Political Science.

But afta some questions bin come up about im education background, e later enta di Atlanta Metropolitan State College wia e also get BSc for Criminal Justice for 2021.

During im campaign, Adeleke bin promise more infrastructural project. For im first term, e bring im five-point agenda wey include: workers and pensioners, Infrastructure, economic growth, education and youth, and pipo welfare.