Atiku campaign promise on fuel subsidy - Wetin oda presidential candidates tok

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/Atiku Abubakar/ Peter Obi/X
Di Independent National Electoral Commission (Inec) don officially open campaign ahead of di 2027 elections on Tuesday 19 August, 2026.
Inec say political parties fit begin do dia campaigns and rallies as dem dey prepare for di 2027 general elections.
According to Inec Chairman Prof. Joash Amupitan, "Wednesday, August 19, 2026, mark di beginning of public campaigns and rallies for di 2027 General Election, while di Presidential and National Assembly elections dey scheduled for January 16, 2027, and di Govnorship and State Houses of Assembly elections for February 6, 2027."
Wit dis declaration, politicians, especially presidential candidates don begin campaign wit interviews and statements about wetin dem go do if dem win and wetin dem don achieve.
Former Vice President and Presidential candidate of di Action Democratic Congress, (ADC) Atiku Abubakar, Vice Presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress, (NDC) Rabiu Kwankwaso and President of Nigeria, Bola Tinubu wey be di Presidential candidate of di ruling All Progressives Congress (APC) don call for Nigerians to reflect deeply on di state of di kontri as dem make dia choice on dia next leaders.
Make we chook eye for wetin dem tok one by one.
'If I win di presidential election, I go restore di subsidy' - Atiku Abubakar (ADC)
Di Action Democratic Congress (ADC) Atiku Abubakar tok say if im win di 2027 presidential election im go bring back fuel subsidy.
Dis na afta tori pipo for di Facebook Media chat online interview ask am about di removal of fuel subsidy:
End of Di one wey oda users dey read well well
Atiku tok say "I initially no oppose di removal of di fuel subsidy. But now wey dem don remove am, wia di money dey? Wia di subsidy money waka go? Dem don use am improve healthcare, education or security?
If I win di presidential election, I go restore di subsidy. And anybody wey bin tiff Nigeria subsidy funds must return di money."
Dis tok by Atiku Abubakar don generate different reactions for social media.
Di Presidency don criticise di former Vice President Atiku Abubakar ova im pledge to restore petrol subsidy if e dey elected president for 2027, dem describe di proposal as deceptive and e dey capable of undermining di kontri economic recovery.
For statement, di Special Adviser to di President on Media and Public Communication Sunday Dare, Dare tok say Atiku dey try to manipulate Nigerians for political gain,e say di former Vice President position fit pause wetin e describe as ongoing recovery across various sectors of di economy.
"Your pronouncement to bring back fuel subsidy dey soaked inside hypocrisy and deceit. Na unpardonable manipulation of public psyche, wey dey designed to hoodwink unsuspecting Nigerians to vote for you.
"Di ongoing recovery across various sectors of our national life dey annoy you, and e fit stop wit dis thinking wey you get if e dey implemented. By di Grace of God, e no go happun and all good men of conscience must rise up against you," e tok.
Between June 2023 and December 2025, subsidy savings mobilized ₦15.8 trillion for di Federation -President Bola Tinubu (APC)
For Nigeria president Bola Tinubu, e bring out some of di tins wey im administration don achieve since e enta seat for 2023.
One of im achievements na di removal of fuel subsidey wey im bin announce on di day wey dem bin dey swear am in as President.
For statement wey one of im tok-tok pesin Sunday Dare post wey dem title 'August 19th. 2026- As di official campaign season open for Nigeria as per Inec time table, Presdent Tinubu Govment bringout compelling narrative on :Nigeria reform scorecard: 12 numbers wey dey tok about di renewed hope story'
For di post di Minister of Finance, Prof. Taiwo Oyedele, present di reform scorecard wey show detail account of di resources wey President Bola Tinubu mobilise under im economic reforms since 2023.
Di breakdown show wia di Tinubu administration get money from and wetin dem use di money do, plus how e don benefit citizens.
One of di points im tok about na di money wey dem get from di removal of fuel subsidy wia dem get 15.8 million naira.
"Between June 2023 and December 2025, subsidy savings mobilized ₦15.8 trillion for di Federation. Dis represents resources following di removal of di fuel subsidy and also dey available within di Federation fiscal system.
For di Breakdown on how Nigeria govment spend di N15.8 trillion-naira saved from fuel subsidy removal President Tinubu ansa quesions wey pipo like Atiku dey ask about wia di money go and wetin Nigeria govment use am do.
Federal govment, States and local govments too also collect dia own share from di fuel subsidy money.
'Our partnership no dey about region, religion or personal ambition, na about Nigeria' - Rabiu Kwankwaso (NDC)
One di oda hand di Vice Presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC) also tok about di 2027 presidential campaign.
Former Kano State govnor tok say make evri Nigerian relect on di kain kontri wey dem wan leave for di next generation.
"Nigeria stand for critical crossroads. Our pipo dey face difficult economic reality. Di rising cost of food and essential goods don place serious pressure on families.
Millions of young Nigerians dey search for meaningful employment and opportunities, while businesses dey struggle wit high operating cost and economic environment wey no dey certain."
Kwankwaso top about di challenges wey farmers for Nigeria dey face expecially di insecurity.
"Insecurity dey kontinu to threaten communities across di kontri. Too many families don lose loved ones, homes and livelihoods to terrorism, banditry, kidnapping and oda forms of violence.
Our farmers need security to return to dia farms, our children need safe schools, and evri Nigerian deserve to live without fear.
Our education and healthcare systems need urgent investment. Our infrastructure must improve, our institutions strengthened, and public resources managed wit greater transparency and accountability."
Di former New Nigeria Peoples Party (NNPP) presidential candidate for di 2023 election add say di problems wey Nigeria dey face too much but im tok say hope still dey to build prosperous and secure nation.
"Dis na why I don chose to work wit His Excellency, Peter Obi, ontop di Obi-Kwankwaso ticket.
Our partnership no dey about region, religion or personal ambition. E dey about Nigeria. We beliv for kontri wia govment serve di pipo, wia dem dey reward hardwork, wia young pipo fit build successful future at home, and wia evri citizen get fair opportunity to prosper.
E beg young pipo women, workers, farmers, entrepreneurs and professionals, to join di journey.
"Make we move beyond politics of division and focus on di issues wey dey affect our daily lives. Make we demand accountability, competence and results from di pipo we trust wit public office.
Di 2027 election present Nigerians wit opportunity to choose new direction."














