Helicopter crash for Ondo state - Wetin we know

Wia dis foto come from, Getty Images
One helicopter don crash for Igbokoda, di headquarters of Ilaje local govment area of Ondo state, southwest Nigeria, police tok.
Di number of pipo on board and weda deaths or injuries dey neva dey clear yet.
Di crash don cause panic for di coastal community, and authorities don deploy emergency and security teams deployed go di area.
Security agencies also neva tok who get di helicopter.
One resident, Olorunlola Oluwafemi, tell BBC say rain bin dey fall wen residents hear “one loud sound like thunder”.
Afta dem realize say no be thunder, e say: “We come outside and discover say na sometin wey look like jet.”
E say smoke bin dey rise from di area wia di aircraft crash.
According to Mr Oluwafemi, di aircraft crash near one forest close to one naval base wey dem know as Forward Operating Base (FOB) for Igbokoda.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Nigerian Navy and oda security agencies don deploy go di area, wia search and rescue operation dey ongoing.
Helicopter crashes for Nigeria
Crashes of aeroplane no dey too common for Nigeria, but recently helicopters just dey crash and land anyhow for di kontri.
For October 24, 2024, Sikorsky SK76 Helicopter wey eastwind aviation operate and wey Nigerian National Petroleum Company (NNPC) charter crash for atlantic ocean near Bonny Finima, Port Harcourt.
Di helicopter bin dey carry personnel go one nuon oil rig wen e crash, wey kpai eight pipo.
For December, 2023 one helicopter wey belong to di Nigerian Air Force bin crash for Port Harcourt wia all di crew members bin sustain injuries.
Di helicopter bin take-off early Friday morning on 1 December heading to Rivers state wit plan for one operation against wetin di force describe as ‘economic saboteurs’.
For August 2023, one aircraft wey belong to di Nigerian Air force bin crash for Niger state.
Tori reveal say di aircraft bin take-off from Kaduna wia e dey go Minna before di crash happun for one village for Shiroro local goment Niger state.
For July 2023, di news of anoda crash bin comot again as one aircraft wey dem dey use train for di Nigerian Air Force crash for Benue state.
Although NAF tok say nobody die for di crash, but two pilots wey dey onboard land hospital sake of di crash.
Dat time, dem setup panel to investigate di cause of di crash wey involve a fighter jet belonging to di NAF.
For February 6, 2023, a maritime patrol aircraft crash land for Lagos. Di aircraft bin dey routine flight before e lose tyres wey make am control di landing go Murtala Muhammed International Airport, Lagos.




















