Police arrest popular Zimbabwe pastor Uebert Angel on top accuse of indecent assault

Zimbabwean self-styled prophet Uebert Angel point im index finger as e dey tok for one public event for 2014. E wear one light grey suit and one red and maroon tie wit one red carnation for di side of im suit.
Wetin we call dis foto, Uebert Angel still dey police custody afta police arrest am ova di weekend
Published
Read am in 5 mins

Police for Zimbabwe don arrest one popular preacher on top allegations of sexual offences.

Authorities arrest Uebert Angel, wey dey lead one international charismatic church wey get branches around di world, during one church service for Harare on Sunday, 22 November.

Fotos and videos of di dramatic arrest don spread online.

For one video wey don go viral, e show as one convoy of vehicles dey escort di self-styled prophet as e siddon for di back of one police van and armed police officers surround dem.

Dem appoint di controversial founder of Spirit Embassy as Zimbabwe special presidential envoy and ambassador-at-large to Europe and di Americas for 2021.

E neva comment on di allegations.

For 2023, e bin make headlines wen one undercover report by Al Jazeera claim say e bin offer to use im diplomatic status to launder large amounts of money through one gold-smuggling scheme for di kontri.

According to di Qatar-based network, 48-year-old Angel tell tori pipo wey dey undercover say na President Emmerson Mnangagwa approve di scheme.

Zimbabwean police bin release one brief statement wey confam im arrest on top accuse of indecent assault and sodomy.

One member of im team tell tori pipo say di British-Zimbabwean national still dey for police custody and e neva dey clear wen e go show for court.

"E fit be di afternoon or tomorrow [Tuesday]. We still dey within di legal framework [for am to appear in court]," Professor Lovemore Madhuku tell state-owned broadcaster ZBC for inside one video dem post online.

Dis no be di first time di popular preacher go dey accused of improper behaviour.

One local online publication ZimLIVE for 2021 bin report say Angel don previously face allegations of sexual offences from several women, at least five of dem dey for England.

Ova di years, Angel don also face gbege for money mata wey dem tok say pass $300,000.

Dem tok say na 2015 e comot for UK to dodge arrest warrant, but for 2016, Harare magistrate Vakayi Chikwekwe cancel am.

Angel sef tok say Zimbabwe financial intelligence unit, FIU clear am afta dem hear tori wey Al Jazeera do for dia Gold Mafia investigation for March 2023.

Di investigation tok say Angel dey involved for international money laundering mata and how e dey misuse diplomatic privileges.

Di charismatic preacher deny di allegations, di outlet bin add at di time.

Angel church get branches for Zimbabwe, South Africa and UK and e dey known for im ties to oda prominent preachers like Malawian televangelist Shepherd Bushiri.

Profile of Uebert Angel

According to im website, pipo sabi Prophet Uebert Angel well-well as di Godfather of di modern-day Prophetic movement.

Na im be di senior pastor of di GoodNews Church (Spirit Embassy) branch dem wey dey around di world.

For im official social media account, e describe imsef as di son of popular Nigerian pastor, Chris Oyakhilome, di founder of Love World wey pipo sabi as Christ Embassy.

Angel be British national, wey do some part of im education for Great Britain.

E get masters degree for Entrepreneurship from Edinburgh University (Napier).

E also get anoda degree for Business and Finance from Salford University, and read post-grad for Education for Bolton University.

E be writer of many books wey include How to Hear the Voice of God, Defeating The Demon of Poverty, and di daily devotional wey be The GoodNews Daily wey im wife dey follow write.

Popular business magazine Forbes bin feature am and e also be Zimbabwe first Presidential Envoy and Ambassador-At-large wey dey responsible for ova 85 kontris to Europe and America.

Dem born am for Masvingo, Zimbabwe, bifor e later waka go Manchester, England, wia e start di Spirit Embassy Ministry.

For March 2023, dem make Uebert Angel ambassador for inter-faith tok and humanitarian mata for di Pan-African parliament of di African Union but dem tok say dem comot am from di position later dat year bicos gbege full ground about how dem take put am for di job.

Uebert Angel marry Beverly Madzudzo, wey be businesswoman and co-founder of Spirit Embassy. Di couple get three children.

Plenty reactions don follow di arrest as some suggest say e be like say na politics dem dey use am play.