Why France shutdown about 500 schools for di kontri

French CRS riot police stand in position for di middle of clashes during one protest by high school students outside di Lycee Deodat-de-Severac high school
Wetin we call dis foto, Authorities deploy French riot police to manage di protests on Friday
    • Author, Jack Burgess
  • Published
  • Read am in 4 mins

French education minister announce say dem go partially or totally close up to 500 schools on Monday, 5 October afta fight-fight between riot police and student protesters wey happun recently.

Édouard Geffray tok say dem go "totally or partly suspend" lessons for some "400 to 500" high schools as security conditions "neva dey fulfilled".

E also say dem "burn or ransack" 24 since di protests start.

Thousands of students dey demonstrate sake of education standards and di protests, wey bin start last week, don spread from Paris to oda cities, wey include Montpellier, Nantes and Marseille.

High school pupils and odas bin don object to di lack of teachers, overcrowded classrooms and run-down buildings.

On Friday, French Justice Minister Gérald Darmanin bin tok say 735 of France 3,700 schools dey affected "one way or anoda" by violent protests.

Di education minister bin warn say di number of schools wey dey potentially affected on Monday fit dey compared to di figure on Friday but im bin promise"partial, progressive return to lessons".

"E get activists - particularly from di far-left - wey don use mago-mago enta di high school student movement, dem hijack am from di students demsefs, and bin dey engage in extreme violence," Édouard Geffray claim.

"Clearly, e dey pose risk to both our staff and our students," im tok. Geffray add say 78 staff members in education don wound, wey im describe as "sometin we neva see bifor".

On Friday na 1,747 pipo dem bin arrest, according to French Interior Minister Laurent Nuñez.

Over 5,000 pipo na im dem don arrest since di start of di movement, according di AFP news agency, and around 85% of dem na minors.

Organisers of di protests bin call for di demonstrations to continue on Tuesday afta dem accuse di govment of lack of "concrete measures", according to AFP.

On Sunday, French Prime Minister Sébastien Lecornu say im govment dey take further steps to "address di difficulties wey high school students and educational staff " dey face.

Im tok say e include to make sure say classes continue, dem improve facilities, dem go oranise di school days beta and make di French university admissions platform more transparent.

Lecornu also tok say govment dey review di "vandal-pays" bill sharp-sharp to make sure say di pipo wey dey responsible for damage bear di cost of dia actions.

Why France dey close di schools

France dey close schools afta kasala burst between students wey dey protest and riot police for some days now.

Di movement wey bin start nearly two weeks ago for low income Seine-Saint-Denis area of northern Paris don spread around di kontri.

E bin hot well-well on Thursday wia dem bin block hundreds of lycées ( di place wey 15 to 18 year olds dey finish dia schooling).

Di situation bin beta small on Saturday but na 400 lycées dem bin close so dat dem fit protect staff and student.

Tori be say universities don begin join di protest.

Do students dey demand for money, more teachers, smaller classes and beta buildings.

Dis protwst don cause ogbonge kasala wey lead to di burning of halls for di lycées and many techers, students and even police pipo don wound.