How Inec mock accreditation exercise ahead of 2027 election go happun across Nigeria

Wia dis foto come from, AUDU MARTE/AFP via Getty Images
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don list 17,656 polling units across di 36 states and di Federal Capital Territory for dia nationwide mock accreditation and result upload exercise wey dey scheduled for Saturday, 28 November.
Di exercise, wey go take place between 8:30am and 2:30pm, na part of di electoral body preparations for di 2027 general elections.
Di commission for one post on dia official X account tok say di exercise, go test di functionality of di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS), assess accreditation procedures and identify possible technical challenges ahead of di elections.
According to Inec, dem say di exercise go hold for two polling units for each of di 8,838 Registration Areas nationwide.
Di announcement dey come for di middle of concerns wey political stakeholders don raise on top di preparation time for di exercise.
African Democratic Congress Presidential Campaign Council on 18 November, bin ask Inec to postpone di exercise, as dem claim say di short notice dem give political parties go affect dia participation.
Dem say di timeline to short and ask di commission to postpone di exercise to allow political parties to prepare and participate meaningfully.
Breakdown of di polling units across Nigeria
Howeva, di list wey di commission release get17,656 polling units, instead of 17,676, wey e suppose be, 20 units lesser dan wetin e suppose be.
Abia: 368 polling units
Adamawa: 425
Akwa Ibom: 658
Anambra: 652
Bauchi: 405
Bayelsa: 210
Benue: 511
Borno: 622
Cross Rive: 370
Kano: 968
Katsina: 718
Oyo: 702
Osun: 664
Gombe: 228
FCT: 124

















