Canada Prime Minister tok about possibility of US military action

Mark Carney stands in front of a Canadian flag
    • Author, Grace Eliza Goodwin
  • Published
  • Read am in 3 mins

Canadian Prime Minister Mark Carney don consider di remote possibility say US fit carry military action come Canada, according to one interview wey e do wit The New York Times.

Carney tell The New York Times say im administration carefully examine di "extreme tail risk" scenario wey US fit take military action against im kontri, and dem don prepare accordingly, but e no give further details.

"I tink say for dis kind position, you get responsibility to look at extreme tail risk," Carney tell The New York Times."

"Na just risk management. No be di main thing wey we expect to happen, but e go dey irresponsible not to prepare."

Tension between di two neighbouring kontris don rise under US President Donald Trump.

Any conflict wey fit happun no go balance at all.

Di US military get more dan 2 million active-duty and reserve troops, while Canada get fewer dan 200,000, according to dia govment.

In di same way, as of 2024, US get 65 military submarines, compared to Canada own four.

Canada, howeva, get di longest coastline for di world and e dey close to di Arctic, two factors wey don make Carney increase defence spending since e take office.

Meanwhile, Trump don frequently tok about Canada as di "51st state". E also start trade war wit dem wey go deep last month as di two kontris begin exchanging tit-for-tat tariffs on number of products.

Even since den, Carney tell di Times, e speak wit Trump "frequently".

"From my perspective, we get good relationship for di sense of we fit pick up di phone and tok to each oda about issues," e tell di outlet.

"E dey direct. I dey direct in terms of wia positions dey. E dey much more efficient dat way, and so you know dat exist and dat go kontinue to exist."

Carney say e believe e still get path to resume trade negotiations wit di US. Returning to dia amicable ties go dey beneficial for both kontris, e say.

Meanwhile, Trump don dey frequently tok about Canada as di "51st state".

E also start trade war with Canada, and di matter bicom deeper last month as di two kontris begin exchange tit-for-tat tariffs on a number of products. Even since den, Carney tell The New York Times say e still dey tok wit Trump "frequently".

"From my perspective, we get good relationship in di sense say we fit pick phone and tok to each oda about issues," e tell di newspaper. "Im dey direct. Me sef dey direct about wia our positions dey.

E dey make tins more efficient dat way, and so you know say dat dey and e go kontinu to dey."

Carney say e believe say road still dey open to resume trade negotiations with di US. Returning to di friendly relationship wey dem get bifor go benefit both kontris, e say.

Canadians react to PM concern

Wetin we call dis Video, A military threat from US? Canadians react to Carney's concerns