Why EFCC declare former Nigeria pension oga Maina wanted again

Maina

Wia dis foto come from, EFFC/X

Published
Read am in 4 mins

Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don declare former chairman of di Pension Reform Task Team (PRTT), Abdulrasheed Maina, wanted again.

Dis new few months wey Maina just serve im eight years jail term finish.

EFCC post on Wednesday 23 September 2026, say dem dey find Maina.

Di anti-graft agency say why dem dey find di former pension oga be sake of connection wit 'alleged receiving of stolen properties.'

For di notice wet EFCC tok-tok pesin Dele Oyewale issue, e say make anybody wey get useful informate on Maina report for dia office.

Dis no be di first time di 61-year-old go get kasala wit EFCC.

For 2015, di anti-graft agency bin declare di former pension reform oga wanted.

Dem say make e come explain im role for inside wetin di commission say na fraudulent biometric contracts, wet dem allege say e carry out.

Di commission also allege say im and one former Head of Service, Steve Oronsaye and two odas allegedly tiff ova N2billion of pension funds.

Bifor Maina become di oga of Pension Reform Task Team, Maina serve as senior administrator for Customs, Immigration, and Prison Pensions Office (CIPPO) for years.

For 2010, dem come appoint am as di chairman of PRTT (Pension Reform Task Team) and e head di task team from 2010 to 2013.

But since dat time, e dey enta wahala for different cases.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Former cases against Maina

For November 2021, di Federal High Court, Abuja sentence Maina, to eight years in prison afta dem find am guilty of money laundering charges.

Di trial judge, Okon Abang, wey deliver di judgement on Monday say Mr Maina tiff over N2 billion Pensioners moni.

Di court say di prosecutor, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring correct evidence through witnesses to prove beyond reasonable doubt say Maina dey guilty of money laundering in di sum of N171,099,000.

Di Court say Maina dey guilty of asking staff of Fidelity Bank to open bank accounts for am without conducting any due diligence.

Di court also say e dey guilty sake of say e hide im identity as signatory to accounts wey im open for UBA and Fidelity bank wit di identity of im family members without dia knowledge.

For October 2019, Federal High Court pass order on say make former pension chairman, Maina go collect self contain for prison.

EFCC bin cari former oga pension go court dat time ontop 12 count charge but afta court read di charges give oga Maina e say im no dey guilty.

EFCC carry Maina and im son go court for N100bn magomago accuse

On Tuesday 22 October, 2019 Justice Folasade Giwa-Ogunbanjo of di Federal High Court bin order Maina to surrender 23 landed properti wey dem trace to am.

Some of di properti na houses, estates and companies wey dey Abuja, Kaduna, Borno and Nasarawa states.

Meanwhile im son, Faisal Maina plead not guilty to di three count charge wey border on money laundering.

Di presiding judge, Justice Okon Abang as dem to take am go lock for Police Tactical Squad pending wen im trial go start.

For 2020, Maina collapse for court.

Di former pension boss collapse wen e lawyer, Anayo Adibe bin dey address di court.

Nigeria government dey investigate Maina on 12-count charge of fraud and money laundering dat time.

On 3 December 2020, one witness for di trial of Abdulrasheed Maina bin tell Federal High Court for Abuja say di former pension oga bin buy properti for Dubai, US and one oda properti for Jabi, Abuja wey worth $2 million.

How Maina mata waka in previous time

•2010 - Chairman of di Presidential Task Team on Pension Reforms

•2012 - Dem accuse am of corruption

•2013 - Dem sack am from federal civil service

•2015 - E enter EFCC wanted list

•2015 - Dem say e begin hide (tori be say e dey for Dubai)

•2017 - Dem appoint am acting Director Human Resources for Interior ministry

•2017 - October 23. President Buhari sack am again from civil service

Profile of Abdulrasheed Maina

Dem born Abdulrasheed Maina for im village for Biu Local goment area of Borno state of Nigeria. Dem born am around 1950.

Abdulrasheed Maina marry Laila Maina and dem get pikin and one of dem, Faisal Maina don chop 14 years prison sentence ontop accuse of money laundering.

Before Maina become di oga of Pension Reform Task Team, Maina serve as senior administrator for Customs, Immigration, and Prison Pensions Office (CIPPO) for years.

For 2010, dem come appoint am as di chairman of PRTT (Pension Reform Task Team) and e head di task team from 2010 to 2013.