US announce new visa restriction policy for pipo wey dey engage in birth tourism and odas

Donald Trump sido dey look front
Published
Read am in 4 mins

US govment don announce new visa restriction policy for foreign citizens wey intentionally travel to di kontri just to born pikin, so dia pikin go be US citizen.

Di Secretary of State Marco Rubio wey announce di informate on Wednesday 23 September, tok say di policy visa restriction go also affect pipo wey dey facilitate birth tourism for di kontri.

"Dis visa restriction policy dey pursuant to Section 212(a)(3)(C) of di Immigration and Nationality Act. Certain family members fit also fall under dis restrictions," Rubio tok for statement.

For June, di Department of States tok say US embassies discova several operations wey allegedly dey use fake documents plus visa "fixers" to help foreign nationals get visa to born for di kontri and secure American citizenship for dia children.

Di department say one US embassy for West Africa bin uncova one network wey involve more dan 100 foreign citizens wey allegedly use fake documents and visa fixers to get US citizenship for dia children.

However, for di latest informate on di mata of birth tourism, di US say di new visa restriction policy go also touch:

  • Owners, operators and managers of commercial birth tourism
  • Visa fixers wey dey coach applicants to commit fraud
  • Foreign medical providers wey knowingly dey abet and facilitate such travel
  • and oda individuals wey dey support, abet, and enable commercial birth tourism

Di US govment say di reason why dem dey restrict di visa of dose wey dey engage for dis kain tin and dey benefit from dis "fraud", na to send clear message say: "United States no go allow foreigners to exploit our immigration system and violate di sanctity of U.S. citizenship."

Bifor dis latest measure, di Donald Trump administration bin earlier don establish task force to end birth tourism for di kontri.

For August, President Donald Trump bin announce new executive orders wey di aim na to end so-called birth tourism for US and limit birthright citizenship for certain groups.

E dey part of one renewed effort by im administration to restrict access to US citizenship afta di Supreme Court cancel Trump first attempt for June.

Already e dey illegal to travel go di US just bicos you wan born your pikin for dia.

According to di executive order, operators for di birth tourism industry dey use deceptive advertising to kolobi foreign nationals to born for di US.

"Dem go promise citizenship; access to public benefits; and short-term stays for specialised facilities, hotels, or rentals, but most times, dem dey fail to deliver on dis promises," di order tok.

How many birth tourists dey for US?

Trump tok say "pipo don born hundreds of thousands" of babies through birth tourism for US, but e no provide evidence or tok if dat figure na annual figure or not.

No govment record dey wey show di actual number of women wey dey travel go America on tourism visas just to give birth, but data dey on foreign residents wey dey born for di kontri

Dis one show say na just 9,500 babies foreign women for US born for 2024, according to di most recent estimate from di Centers for Disease Control (CDC). Dis na based on births registered to mothers wey get foreign addresses.

In comparison, na 3.7 million US births in total dey dat same year, CDC figures show, and dis one mean say babies born to foreign US residents amount to roughly 0.25% of dis.

However, MPI say govment figures fit no correct as foreigners fit use US address wey no be dia permanent home to register a birth.