Premier League Player of di Year: Declan Rice, Bruno Fernandez, Haaland, Raya make list

Declan Rice, Erling Haaland, and Bruno Fernandez

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 5 mins

Just two matches remain for di 2025/2026 English Premier League season to finish, and on di nominations for who be best player of di season don come out.

Wit Arsenal sitting on top of di league table e no be surprise say na dia players dominate di least wit three out of di eight nominees for di ogbonge award.

Here na di nominees:

Bruno Fernandez

Bruno Fernandez

Wia dis foto come from, James Gill - Danehouse/Getty Images

Wetin we call dis foto, Bruno Fernandez wey don already win di FWA player of di season award, need just one more assist to equal di record of highest assist for inside one season.

Di Manchester United playmaker don already chop di Footbal Writers Association award for player of di season, and many pipo say e be favourites to win dis one two.

Fernandez reject one big money contract to go to di Saudi Pro League for di end of last season, rada e chose to remain wit di Red Devils even though dem bin no qualify for any European tournament.

So far, di Portuguese don bak up dat decision wit many goals and assists to make sure say di Old Trafford boys go qualify for di Champions League dis season.

Wit a total of 19 assists currently, Fernandez na numba one assist provider for di league dis season, and e need only one more assist to equal di highest assist by one player for inside one season, and wit two matches to play, im chances to hit dat record or even pass am, plenty.

Declan Rice

Rice don dey nominated as player of di season for all di three seasons wey e don spend for Arsenal so far, and if tins remain as dem be now, e fit dey third-time lucky and lift di EPL trophy wit di gunners.

Apart from goalkeeper David Raya, no oda Arsenal player don play more match minutes dan Rice, and na im also don create di highest big chances for di club dis season.

Di England midfielder don play for 35 out of di 36 EPL matches wey di Gunners don play so far, and if e remain fit, e sure say e no. go miss di last two matches for anything in di world.

David Raya

If Arsenal win dis EPL trophy dis season, plenty of di accolades suppose go to dia Spanish goalkeeper David Raya.

Raya dey lead di race for di golden glove award currently wit 18 clean sheets, and many times dis season na im be di difference betwin three points and one point for di Gunners.

Big example na for dia last match against Westham wia Raya take im leg block one ogbonge attempt wey e sure say e for enta net for di dying period of di game.

Raya na di only Arsenal player wey don start evri single EPL match dis season, im na also di only goalkeeper wey dem nominate for dis award and if e win am, e go be just di second goalkeeper to win am since Peter Schmeichel for di 1995/96 season.

Gabriel Magalhaes

Di third Arsenal nominee for di list, Gabriel don show imsef as a true leader for dis Gunners side.

Weda na to provide ogbonge defencive play, abi na to go forward go cause trouble during cornerkicks or freekicks, di Brazillian don really give good account of imsef.

Only one Brazillian bin don win di EPL player of di season award since dem start to dey give am more dan 30 years ago; dat pesin na Juninho for 1996/97.

Gabriel fit break dat jinx?

Erling Haaland

Erling Haaland

Wia dis foto come from, Naomi Baker/Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Norwegia striker don dey nominated for player of di season almost evri year since e join Manchester City for 2022, na only last season e miss out

Pep Guardiola goal machine, Haaland, don dey break evri record since e join di EPL for 2022.

Na only last season dem no nominate am for player of di season, and so far dis year, di Norwegian striker dey on top of highest goal scorers chat wit 26 goals.

Also e don win top scorer for di season two times, and if e win am dis year e go join di exclusive company of pipo wey don win di award for three seasons; names like Alan Shearer, Thierry Henry, Mohammed Salah and Harry Kane.

Morgan Gibbs-White

Northingham Forest just manage to avoid relegation as dem currently dey for di 16th position for di league table, but Morgan Gibbs-White really shine for dem dis season.

E don also add scoring goals to im official role as a midfielder, wit 13 goals so far.

Many sabi pipo tok say im performance dis season fit don earn am a call-up to di English national team for di 2026 World Cup in July.

Antoine Semenyo

One of di revelations of di season, Semenyo bin start di season as a Bournemouth FC player, but e dey end am for di blue side of Manchester.

Man City sign am for di January transfer and e continue from wia e stop, scoring goals and creating chances to make sure say di Citizens continue to dey mount pressure on Arsenal for di league title.

Di Ghanaian international score di first goal for Wednesday night as City trash Crystal Palace 3-0 to remain witin two points of Arsenal wit two more games to go.

Dwight Yorke (Aston Villa and Manchester United) na di only pesin wey win player of di season afta e play for two clubs for inside one season, and dat na for 1998/99.

Igor Thiago

If Brentford sabi one tin wella, dat tin na how to sign world class strikers; Ivan Toney comot go Saudi, Mbeumo replace am, and wen e comot go Manchester United, Igor Thiago replace am fast-fast.

So far, di Brazillian don score 22 goals, just four behind Haaland who get 26, and e don make am into di provisional World Cup squad list of Carlo Ancelloti for di Samba boys.

Twenty-two goals na record for di highest goals wey any Brentford player don score for inside one season. Na also record for di highest goals wey any Brazilian player don score for inside one season for di English Premier League.