Jose Mourinho dey come back as Real Madrid next manager?

Jose Mourinho wit red chair at di back

Wia dis foto come from, Carlos Rodrigues/Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Jose Mourinho don dey final negotiations to become Real Madrid next head coach, 13 years afta im first spell for di Bernabeu.

Di 63-year-old na di clear favourite - and currently di only candidate Real Madrid dey tok wit ova di role.

Mourinho go replace current head coach Alvaro Arbeloa, wey take charge for January afta Xabi Alonso comot.

Real Madrid president Florentino Perez first consider di possibility of Mourinho return two days afta Xabi Alonso comot from di club.

Mourinho na manager of Benfica, for im native Portugal, afta e join dem on two-year contract last September.

Yesterday, e tell media say e no wan tok about im future yet.

"Match dey against Estoril, and from Monday onwards I go fit to ansa kwesions about my future as coach and Benfica future," e say.

Saturday game against Estoril Praia na Benfica last game of di season.

From Sunday, Real Madrid go now get di window to complete deal for Mourinho wit small money

One clause for Mourinho contract allow am to comot for di club for 3million euros (£2.6m) up to 10 days afta Benfica play dia final match of di season.

Mourinho dey incharge of Real Madrid between 2010 and 2013, wia e win La Liga, di Copa del Rey and di Spanish Super Cup.

Afta leaving di club e return to England at Chelsea, winning di third of im three Premier League titles, plus di EFL Cup, for 2014/2015 season.

Afta im leave di Blues by mutual consent in 2015, Mourinho den joined Manchester United on a three-year deal in 2016.

E win di Europa League, EFL Cup and Community Shield during im first season for Old Trafford but dem sack am for December 2018 afta im poor results.

Meanwhile, Real end dia 2025/2026 campaign trophyless, wit rivals Barcelona sealing di La Liga title wit 2-0 El Clasico victory and by 14-point margin.

Los Blancos Champions League run end wit 6-4 aggregate defeat by German champions Bayern Munich for di quarter-finals.

Why Mourinho as Real Madrid manager?

Di tactics behind Real Madrid decision dey clear. Di club no dey only find tactical coach, dem dey find manager wey dey capable to restore authority, identity and emotional control todi club afta a turbulent season.

One of di biggest reasons behind Mourinho appeal na di current state of di dressing room, afta di clash between Tchouameni and Valverde.

Earlier dis month, defender Alvaro Carreras dey forced to respond to reports linking am to a disagreement wit team-mate Antonio Rudiger.

E also get anoda growing noise around Kylian Mbappe afta di forward travel to Sardinia during im recovery from hamstring injury.

Di trip cause kalasa among supporters, wit an 'Mbappe Out' petition reportedly attracting more dan 73 million signatures.

Wit di dressing room wahala and di club reputation on di line, Real Madrid need strong leader to help di team back on course next season.