Arsenal enta dia first Champions League final in 20 years as dem beat Atletico Madrid 2-1 aggregate for semi-final

Wia dis foto come from, Getty Images
Afta 20 years of trying, Arsenal don finally make am to di final of di Champions League afta dem sama Atletico Madrid 1-0 for Emirates Stadium on Tuesday 5 May.
Na Bukayo Saka score di only goal of di game for di 44th minute. Dem bin draw 1-1 for di first leg for Madrid last week.
Di Gunners, wey secured 2-1 semi-final aggregate victory, go face either title-holders Paris Saint-Germain or Bayern Munich for Budapest, Hungary, for 30 May.
Arsenal neva win di Champions League bifor, and dia two major European trophies na di 1994 Cup Winners' Cup and di 1970 Inter-Cities Fairs Cup.
Dis season na ogbonge season for di Gunners as dem dey chase Premier League and Champions League double.
Second half
Full Time Arsenal 1-0 Atletico Madrid (2-1 aggregate)
90+5 Match don end Arsenal don enta di Champions League final.
90+4 Arsenal coach Mikel Arteta collect yellow card too.
90+3 Atletico Coach Diego Simeone don collect yellow card sake of say im no fit control im emotions again.
90+2 Arsenal dey try to tighten dia defence more make Atletico no get chance for dis closing minutes.
90+1 Injury time!
90' Referee add five minutes
86' Dem play beta ball go meet Alexander Sorloth but im leg no balance make e for fire shot.. It's poor for a striker, he'll be disappointed.
85' Atletico Madrid fans dey cry.
83'SUBSTITUTION
Gabriel Martinelli don enta for Leandro Trossard as di match don dey end.
83' Arsenal get free-kick and dem no dey rush to play am. Di cross land for di back post but William Saliba heads am comot.
81' YELLOW CARD
Marc Pubill enta referee book for foul on Viktor Gyokeres. Im bin dey hold am back for sometime.
80' Good cross into di box from Marcos Llorente for Atletico but Arsenal goalkeeper David Raya tip am comot from goal and nobody bin dey to follow up di ball.
77' Beta ball land for Arsenal box but David Raya catch am.
74' SUBSTITUTION
Maritn Zubimendi don replace Myles Lewis-Skelly. Arsenal are just over 15 minutes away from the Champions League final.
70' Risky ball from Nahuel Molina,e pass straight across im own 18-yard-box and Ben White dey alert. Im trap di ball as im drags di effort away from danger.
68' SUBSTITUTION
More changes for Diego Simeone Atletico Madrid
Alex Baena and Thiago Almada don enta for Julian Alvarez and Antoine Griezmann.
67' CHANCE! Viktor Gyokeres for don seal Arsenal place for di final but e miss di chance to put di ball inside di box, Im shot fly over di bar
65' Atletico get free-kick but Arsenal players use head nod Antoine Griezmann shot comot.
Julian Alvarez of Atletico bin try to score but di ball bin too dey close to Arsenal goalkeeper David Raya, e no hard am to catch di ball.
62' Atletico look more dangerous for dis second half. Dem don fire more shots and get more action near di goal area.
59' SUBSTITUTION
For Arsenal, Riccardo Calafiori, Eberechi Eze and Bukayo Saka comot while Noni Madueke, Martin Odegaard and Piero Hincapie enta.
Atletico Madrid don make changes as Ademola Lookman, Giuliano Simeone and Robin Le Normand comot, for Johnny Cardoso, Alexander Sorloth and Nahuel Molina enta.
57' Riccardo Calafiori dey lucky for here. Like say referee blow whistle im for risk penalty.
56' Beta save! Antoine Griezmann fire beta shot wit im right foot just inside di area but Arsenal goalkeepe David Raya save di ball.
Referee blow whistle for foul on Gabriel but Riccardo Calafiori foul Griezmann too.
55' Good run from Declan Rice and he lays it off to Viktor Gyokeres to his right but there's a brilliant block in there from Marcos Llorente.
54' Atletico don dey wake up for dis match, dem no get choice but to put evritin down if dem wan enta final.
52' VAR bin check for penalty but Gabriel challenge dey okay fair as im win di ball.
51'Gabriel recover fast -fast as Giuliano Simeone make one beta run and e try beat Arsenal goalkeeper David Raya, wey bin no dey concentrate, and di Brazilian challenge am to stop di goal bound ball.
48' Declan Rice of Arsenal dey on alert afta one loose pass from Atleti reach Marcos Llorente but e foul Leandro Trossard to stop Arsenal make dem no creating any opportunity.
47' Beta ball land for di penalty area but Ademola Lookman no fit turn im effort on target.
46' Second half don start
First Half
Half time
Arsenal 1-0 Atletico Madrid (2-1 aggregate)
45+1 Referee blow whistle for half-time 45' Arsenal don put one leg inside di final as Viktor Gyokeres hold di ball for di right-hand side, im pass di ball give Leandro Trossard, im fires towards di bottom corner and Jan Oblak push am comot but e go meet Bukayo Saka wey fire di ball again and e enta for bottom corner of di net.
45' GOALLLLLL Bukayo Saka score for Arsenal
43' Beta play from Arsenal around di box but Matteo Ruggeri put im toe to get di ball as e stop di attack make e no progress.
36' NO PENALTY! VAR no even waste time look am bifor dem conclude.
Arsenal get anoda corner, dem play am but notin come out.
34' Di home supporters dey scream for penalty as e be like say Antoine Griezmann bring down Leandro Trossard just inside di box. VAR dey look am.
29' Beta opportunity for Atletico but linesman raise flag up to show offside.
Really nice play down the right-hand side and Antoine Griezmann finds Giuliano Simeone to his right who squares to Marcos Llorente, but he's flagged as offside.
25' Dem finally play di corner kick but e dey short and eventually land for Myles Lewis-Skelly, im hold di ball up well, e cross di ball but e pass di face of di goal, nobody dey dia totap am inside net.
24' Arsenal neva score from any of dia last 42 corner kicks wey dem don play for di Champions League, since dem bin score from one against Inter for January.
Dem bin get anoda corner opportunity as Declan Rice try to cut am back but players block am.

Wia dis foto come from, Getty Images
22' Viktor Gyokeres try to run go near di ball but e ends up running into im own team-mate Bukayo Saka. Im end up wit fouling Koke as bin try to kick di ball from im leg.
19' Big chance for Arsenal! Ben White play beta ball for di right-hand side, im cut di ball give Bukayo Saka but im effort go off target.
Gabriel has a go from range but he drags it just wide of the post.
17' Arsenal get corner kick and Bukayo Saka get plenti space for back post but im no really know wetin to do wit di ball, e finally play di ball go side of di net.
16' Bukayo Saka of Arsenal pass di ball and Ben White get foul on Koke while im bin dey try to mop up.
11' Antoine Griezmann of Atletico Madrid cut di ball back from close range, e carry di ball go near di line and Arsenal goalkeeper David Raya punch di ball comot but Giuliano Simeone bin dey come meet am. Declan rice block di shot. Declan Rice wey bring out im leg at di right time na wetin save dat ball.
8' Antoine Griezmann of Atletico Madrid release Giuliano Simeone down for di right-hand side and im put di ball across for Julian Alvarez but di Argentine no fit put di ball on target.
6' Plenti action neva too dey but Arsenal dey get beta ball possession.
Antoine Griezmann don get warning for foul on Eberechi Eze.
2' Beta atmosphere for di Emirates as Arsenal beg get early ball possession.
1' Match don start

Wia dis foto come from, Getty Images
Line up
Arsenal starting XI:Raya (GK), Calafiori, Gabriel, Saliba, White, Rice, Lewsi-Skelly, Saka ©, Eze, Trossard, Gyokeres
Atletico starting XI:Oblak (GK), Pubill, Le Normand, Hancko, Ruggeri, Simeone, Llorente, Koke, Lookman, Griezmann, Alvarez
Di stage don set now, two ogbonge teams dey meet each oda to find who go reach di Champions League final.
Arsenal coach Mikel Arteta select strong team to face di Spanish club for di Emirates stadium.
Di Gunners dey hope to win dia first European crown but dem gatz first reach di final.
If dem qualify dem go reach dia first final since 2005 wey Atleico bin dey wan win di trophy afta dem bin lose am for di final for 2013 and 2015.
Dis na di lineup for di two teams.
But both competitions be different, in fact di two coaches also get different motivation and objectives.
Arsenal be di only club wey neva lose any game for di Champions League dis season (W10 D3).
Dem also get di best defence sake of dem collect only six goals so far wey dem keep eight clean sheet.
For Atletico Madrid for di oda hand, dem bin play 37 Uefa Champions League games wey dem score for each of dem.
Arsenal bin beat Atletico 4-0 for di league phase earlier dis season but wen di two teams bin meet for di last time ova two legs, na Atletico Madrid wey win 2-1 for di Europa League semi-final for 2017.
Dem both dey chase dia first European crown but Arsenal wan reach dia first final since 2005 wey Atletico bin dey wan win di trophy afta dem bin lose am for di final for 2013 and 2015.
Some fans say di two teams go play 'haram' football - di kain football wey dem go defend di whole game and carry just one or two chances to score.
But dis no dey bother Arsenal coach Mikel Arteta.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin di two coaches tok?
Arsenal coach Mikel Arteta say, "I no fit wait for dis game, I don dey feel di energy for di team and our supporters, dis be di kain moment wen we gatz live togeda."
Di Arsenal manager tok Uefa.com say "we get plenti work to do for dis club afta 20 years to dey for dis position again".
Fans for di club don dey smell some hope say dem fit even win di double (Premier League and Champions league) if dem try dia best.
Arteta say "we dey so hungry to get di kain we dey want and go thru to di final".
Striker Viktor Gyokeres wey don return to form wit three goals for im last two games tok say di team dey positive ahead of di game.
"We dey hia for one reason, we don do well throughout di season na dis be di crunch time."
Gyokeres don add say "we gatz cross di line dis time, we don do our best so far but we suppose do dis last one to reach di final for di Champions league".
Arteta go hope say di Swedish striker go carry im form enta di match and score to carry di Gunners reach di final.
But im gatz do dat against Diego Simeone and im team wey don begin to focus for di title afta dem lose di Copa Del Rey final against Real Sociedad for penalties.
Simeone say, "I go tell my players to play di way dem bin play for di second half of dat first leg game for our home."
"We go try to play di game wey we suppose play, wit intensity. We get faith for wetin we fit do."
Antoine Griezmann wey don dey leave di club for di end of di season tok say "dis game go dey fine, na match evribodi wan experience wey we hope say we fit show di right attitude and handle di pressure".
"Na only one step to di final, di team sabi dis tin wey we get confidence for camp. We gatz dey tactically and defensively sound and continue to show di standard we bin show for our home match last week."

Wia dis foto come from, Getty Images
Team news
Bifor di game, striker Julian Alvarez bin dey doubtful afta im pick injury for di first leg of di match for di Metropolitano but im dey fit to play di second leg.
Alexander Sorloth and Giuliano Simeone wey bin pick knocks for dia league game against Valencia travel wit di squad to London.
Jose Jiminez and David Hanko both dey available.
Di only players wey go miss dis game na Nico Gonzalez and Pablo barrios.
Diego Simeone go hope im team go dey fresh and ready for di game for di Emirates.
For Arsenal, Mikel Arteta confam say injury doubts Kai Havertz and Martin Odegaard dey ready and available.
"Dem dey available, sake of we dey need options and capacity to play different games on Tuesday, weda na from di beginning or afta - so na good say Kai and Odegaard dey available."










