Who be Lula da Silva wey win historic fourth term as Brazil president

Lula, wit white beard and in a white button-down shirt, smiles as e stand through the sunroof of a rain-speckled vehicle, reaching out to shake hands wit supporters wey dey stretch dia arms and holding up smartphones to record di moment. DI scene takes place on a crowded street. Behind am na concerned looking man watching closely (a security agent?)
Wetin we call dis foto, Lula bin greet supporters afta im vote on Sunday
    • Author, Marina Rossi
    • Role, BBC News Brasil
    • Reporting from, São Paulo
    • Author, Leandro Prazeres
    • Role, BBC News Brasil
    • Reporting from, Brasilia
    • Author, Vanessa Buschschlüter
    • Role, Latin America online editor
    • Reporting from, London
  • Published
  • Read am in 4 mins

Brazil veteran left-wing president, Luiz Inácio Lula da Silva, don dey re-elected afta one bitterly fought campaign, beating im right-wing rival Flávio Bolsonaro.

Afta dem count all di votes, Lula bin get 51.79%, wey Bolsonaro get 48.21%, Brazil Superior Electoral Court don announce. Bolsonaro no yet concede defeat.

But dat neva stop Lula, wey go clock 81 on Tuesday (27 October), from celebrating im fourth win for presidential election for di kontri.

Di road to victory for di Sunday run-off no be smooth tin at all. No president for di democratic history for Brazil ever bin win re-election for second additional term. To win afta im finish second for di first round dey unprecedented.

Lula also bin change di trend for Latin America, wia voters don punish incumbent presidents and turn to di right.

Brazil's President Lula da Silva in a blue shirt deliver victory speech while Federal Deputy Andre Janones hug am, and dem dey surrounded by group of pipo laughing and clapping, including First Lady Rosangela 'Janja' da Silva, Vice President Geraldo Alckmin and oda coalition leaders.
Wetin we call dis foto, Re-elected President of Brazil Luiz Inacio Lula da Silva bin deliver victory speech for im election headquarters inside di Intercontinental Hotel for Sao Paulo, Brazil, on October 25, 2026

Lula im campaign bin ginger again afta im lose for di first round for dis election.

Di 80-year-old bin lead ogbonge social media campaign wit street demonstrations.

Di former metalworker however don dey face di most challenging political landscape since im first become president for 2003.

Im fresh tenure go begin on 5 January 2027, as wahala bin dey home and abroad including wahala from US President Donald Trump.

Trump neva endorse Flávio Bolsonaro directly – sometin im bin do wit di right-wing candidates wey bin later win presidential elections for Colombia and Honduras – no be new tin say im administration go prefer conservative pesin to lead di kontri of 213 million pipo.

Di White House dey see Latin America as area of US influence and di Trump administration dey serious to reduce Chinese influence for di Western Hemisphere.

Brazil, wey be rich for oil wey also bi di world's second-largest reserves for rare earth minerals, na di only big kontri for South America wey no dey governed by right-wing leader, pipo dey see Lula as China-friendly.

Flávio Bolsonaro bin promise to align Brazil closely wit Washington while Lula bin warn di US say make dem no chook mouth for di election wey dem insist say Brazil go "neva fit into anybody im backyard".

Dis Lula victory go dey welcome by environmentalists wey bin dey fear say election win for Flávio Bolsonaro go give Brazil dia ogbonge agribusiness and mining sectors more power.

Dem bin show record of high level of deforestation and forest fires for di Amazon during di presidency of im papa, Jair, wey dem argue say under di younger Bolsonaro, laxer environmental policies go fit destroy more tins for di ecosystem.

Even though im supporters dey happy about di victory, di result bin dey show say di kontri don dey deeply divided, wit 48.21% percent voting for im right-wing rival.

Apart from di fact say im gatz unite dis kontri wey don divide, Lula gatz govern alongside di most right-wing Congress for di Brazil dia democratic era. Flávio Bolsonaro's Liberal Party (PL) na di party wey don benefit for dis election.

Bifor di election, Lula bin describe di poll as "parting of di waters for Brazil".

Im promise to bridge di gap between Brazil opposition political poles wit "new way of governing", wey im add for one WhatsApp livestream bifor di election say "dis kontri go neva be di same again".

A woman wearing red t-shirt covered in stickers hold a massive cutout of Lula's face and hat while another woman wearing the Brazilian colours of yellow and green carries a Brazilian flag. Behind them lots of people mill about in a busy tree-lined street.
Wetin we call dis foto, Lula supporters for Rio bifor im win di vote

Even though im no give plenty detail about im new way to lead di kontri, Lula insist say im go "remain firm for di fight for more just kontri, wit opportunities for all and policies wey go help to solve di needs of di population".

Wit di fact say di Congress dey hostile, dis fight go dey hard pass di last three terms for office, for di veteran leader, wey go chop almost 85 by di time im finish dis new term for office.