Special court for Edo say make dem kpai convicts by hanging afta Govnor Okpebholo vow to sign death warrants - wat next?

Convicted criminals
Published
Read am in 4 mins

Edo State Special Criminal Court, south-south Nigeria, don sentence four kidnappers for di state to death by hanging.

Justice Aigbona Momodu sentence di four suspects to death sake of say dem bin kidnap one woman for di Vegetable Market along Airport Road for Benin City.

Na on 14 June, 2026 wey di armed men bin kidnap one woman for front of her husband and children for di popular Vegetable Market along Airport Road for Benin City, Edo State.

Na for July di Edo State govment set up di special court to chook eye sharp sharp ontop violent crimes like cultism and kidnapping cases.

Di state govment sama di suspects 11-count charge wey include kidnapping, conspiracy, armed robbery, cultism, and unlawful firearm possession.

Dis na di first time di court dey give judgement afta dem set am up for July, 2026

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

'Dem go hang you for neck until you die. May di Lord get mercy on your soul' - Justice Aigbona declare

Di court judgement read: "Second defendant, for count one, you, Wisdom Michael, dey hereby sentenced to seven years imprisonment.

"For count two, three, four, five, six, seven, eight, and nine, you, Wisdom Michael, dey hereby sentenced to death by hanging or through di administration of lethal injection.

"Dem go hang you for neck until you die. May di Lord get mercy on your soul.

"Third defendant, for count one, you, Rufus Emete Michael, dey hereby sentenced to seven years imprisonment.

"For count two, three, four, six, and seven, you, Rufus Emete Michael, dey hereby sentenced to death by hanging or through di administration of lethal injection.

"Dem go hang you for neck until you die. May di Lord get mercy on you.

"Fourth defendant, for count one, you, Gift Raphael, dey hereby sentenced to seven years imprisonment.

"For count two, four, six, and eight, you, Gift Raphael, dey hereby sentenced to death by hanging or through di administration of lethal injection. Dem go hang you for neck until you die. May di Lord get mercy on you."

Wetin go happun next for di suspects wey chop death sentence?

Normal situation for regular courts be say if di defendants no agree wit di decision of di judge dem fit appeal di judgment for di Court of Appeal.

Na di same tin go happun for any judgement wey di Special Court for Edo State give becos dem still dey under di normal court structure.

Di only difference be say di court dey attend to cultism and kidnapping cases only to make di hearing and judgement sharp-sharp.

Dis appeal still depend on wetin di defence lawyers get to use defend diasef for di Appeal Court.

Na for July 2026 Edo State Govnor Monday Okpebholo tell di chief judge of di state to bring special court wey go handle cultism and kidnapping cases sharp-sharp.

Dis na sake of say Edo State dey face high kidnapping and cultism related issues wey make di govnor para well-well to take dis step.

Im bin cut warning for di suspects and odas wey dey do dis crime say e ready to sign di death of anybodi wey di court convict.

For one video wey bin go viral wen Edo State Police Command bin parade di suspects, oga Okpehbolo bin advise criminal for di state to stop or else dem go lose evritin including dia life.

"I go sign your execution hanging, I go carry you go Ring-road roundabout so dat di whole Edo pipo go see you," e promise dem.

E neva dey clear weda di lawyers for di defence team go appeal di judgement for di Appeal Court or Govnor Monday Okpebholo go keep to im promise to sign and execute di convicts.