South Africa police dey investigate murder of foreign citizen wey be victim of assault

South Africa police dey on duty wit dia protective shield
Wetin we call dis foto, South Africa police
Published
Read am in 3 mins

Police for KwaZulu-Natal Province dey investigate di circumstances around di murder of one foreign citizen, wey dem believe say dey in im his late 30s or early 40s.

Police say one group of pipo allegedly assault am to death on Thursday morning, 22 October 2026.

Authorities say early reports wey dey available suggest say di group of pipo bin dey march on Dr Pixley kaSeme Street towards Maud Mfusi Street for Durban city centre.

During di march, tori be say two men comot from di group and waka go meet one man wey dey for di roadside.

Provincial tok-tok pesin Colonel Robert Netshiunda say: "Dem further allege say di group of about 50 pipo assault di man wey dem declare dead for di scene.

"Police dey follow several leads and use all investigative aids to identify possible suspects. Di motive of di killing dey unknown at dis stage and dem dey beg community members make dem no dey spread unverified information"

Di protests na di latest for di series of demonstrations for di city in recent weeks wey be about service delivery complaints and anti-immigration riots.

However police tok say e neva dey clear at dis stage if di attack dey linked to anti-migrant sentiment.

Dem neva know di kontri wey di victim come from.

Netshiunda tell di BBC say dem no go fit guess on di motive of di killing and say dem go share more information once dem verify am.

Dis na developing tori - refresh for more informate as we dey update am