You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
World Cup 2026 song wit Shakira and Burna Boy - Wetin to know
Colombian pop star Shakira don announce her official song for di 2026 World Cup.
Di 49-year-old wey be di star on di songs like Whenever, Wherever and Hips Don't Lie bin announce say she go drop Dai Dai on Thursday, 14 May as di anthem for dis year World Cup wey go dey jointly hosted by di US, Mexico and Canada.
Shakira use her hand post one minute teaser video for Instagram wey she bin shoot for inside di Maracana stadium for Brazil to tease di song wey she follow do wit Nigeria singer Burna Boy.
Dis go make am Shakira second official World Cup anthem afta 'Waka Waka' wey she run for 2010 World Cup wey hapun for South Africa.
She bin also work for di 2014 tournament wit di song La La La (Brazil 2014) wey she perform for di end of di ceremony for Rio de Janeirp.
Shakira wey get two pikin for former relationship wit ex-Spain and Barcelona defender Gerard Pique, bin also sing Hips Don't Lie for di 2006 closing ceremony for Germany.
Her kontri, Colombia na part of di 48 teams wey go participate for di tournament wey go run from 11 June to 19 July.
Dis no be di first 2026 World Cup anthem though.
End of Di one wey oda users dey read well well
For March, Fifa release di first World Cup sound wey dem call Lighter. Di song bin dey performed by American artist Jelly Roll and Mexican singer, Carín León.
Fifa bin reveal dat time say di track na di first chapter for "groundbreaking album for di most inclusive Fifa World Cup in history".
According to Fifa, oda songs wey dem don release for dia World Cup album include Illuminate wey Canadian singer, Jessie Reyez and Palestinian singer Elyanna follow sing; Echo wey Despacito singer, Daddy Yankee and Jamican singer, Shenseea sing inside and Por Ella wey Mexican musical group Los Ángeles Azules and Mexican singer, Belinda bin sing.
Burna Boy no go be di first Nigerian wey don do sing for World Cup.
Dis na as for 2022, Davido bicome di first Nigerian to sing di World Cup anthem wey e sing wit Trinidad Cardona and Aisha. Di name of di song na Hayya Hayya (Better Together). E bin later go for di finals of Qatar 2022 to perform di song live.
Oda gbonge stars wey don sing na Nicki Minaj and JungKook of BTS among many odas.
Wetin be di World Cup songs and anthems ova di years?
E take 60 years afta di World Cup bin first launch bifor dem start to dey do World Cup anthem for di tornalment.
Na for 1990, World Cup anthems start to bicom sometin wey dem dey regularly do.
Howeva na for Qatar 2022, Fifa start to dey do multi song collection wey go feature as dia World Cup anthems.
- Italy 1990 - Un'estate italiana (To Be Number One) by Edoardo Bennato and Gianna Nannini in Italian and Giorgio Moroder Project in English
- United States 1994 - Gloryland by Daryl Hall and di Sounds of Blackness
- France 1998 - La Cour des Grands (Do You Mind If I Play) by Youssou N'Dour and Axelle Red na di official song; Cup of Life (La Copa de la Vida) by Ricky Martin bicom offica anthem
- South Korea & Japan 2002 - Boom by Anastacia na official song while Anthem by Vangelis turn official anthem
- Germany 2006 - The Time of Our Lives by Il Divo and Toni Braxton as offcial song and Zeit dass sich was dreht (Celebrate The Day) by Herbert Grönemeyer featuring Amadou & Mariam as official anthem.
- South Africa 2010 - Waka Waka (This Time For Africa) by Shakira featuring Freshlyground as official song; Game On by Pitbull, TKZee and Dario G as official mascot song; and Sign of a Victory by R. Kelly featuring di Soweto Spiritual Singers as official anthem. (K'naan Waving Flag bin dey used as Coca Cola theme song for dis World Cup)
- Brazil 2014 - Ole Ola (We Are One) by Pitbull, Jennifer Lopez and Brazilian star Claudia Leitte as official song, Tatu Bom de Bola by Arlindo Cruz as official mascot song and Dar um Jeito (We Will Find a Way) by Carlos Santana featuring Wyclef, Avicii, and Alexandre Pires as official anthem
- Russia 2018 - Live It Up by Nicky Jam featuring Will Smith and Era Istrefi na di official song.
- Qatar 2022 - bin feature a Fifa world cup album wey include Hayya Hayya (Better Together) by Trinidad Cardona, Davido and Aisha; Arhbo by Ozuna and Gims; Ulayeh by Sebastián Yatra and Nouamane Belaiachi; Vamos A Qatar by Los Bukis; Light the Sky by Balqees, Nora Fatehi, Rahma Riad and Manal; Tukoh Taka by Nicki Minaj, Maluma and Myriam Fares and Dreamers wit JungKook from BTS.