US go close down 30 embassies across African cities

Foto of US President Donald Trump

Wia dis foto come from, Francis Chung/Politico/Bloomberg via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Di US State Department don plan to reduce dia embassies and consulates from 50 to 20 for Africans wey wan enta United States.

US don annouce say dem go cut down 30 US embassies and consulates wey dey process visa application to Africans and leave 20 in di coming week, according to AP.

According to one internal memo dem neva set date wey dem go implement dis changes, but e go happun for June.

Dis move dey come afta Trump administration impose restriction on some African nations, wia dem dey go pay $15,000 as a requirement for B1/B2 visas applications into di US.

Although, foreign ticket holders from kontri wey qualify for di World Cup no go pay bonds to enta US

Trump admistration plan to limit immigrant and non-immigrant visas as dem dey try reduce foreigners wey dey immigrant into U.S. and some travellers wey dey travel wit temporary visas but dey overstay.

Under one directive wey US Secretary of State Marco Rubio issue last week, di State Department go reduce consular operations in all but 20 "hubs" for Africa.

Di State Department inside dia memo tok say "dem dey constantly evaluate dia overseas operations in order to deploy taxpayer resources in a way wey go advance America priorities as efficiently and effectively as possible."

E add, "including visa process wey go maintain rigorous standards of security screening and vetting wey go align wit resources and operational capacity within di America national interests."

According to di memo, dem go only open di embassies and consulates for 20 wey go operate for Abidjan, Ivory Coast; Accra, Ghana; Addis Ababa, Ethiopia; Cape Town, South Africa; Dakar, Senegal; Dar-Es-Salaam, Tanzania; Djibouti, Djibouti; Johannesburg, South Africa; Kampala, Uganda; Kigali, Rwanda; Kinshasa, Congo; Lagos, Nigeria; Lome, Togo; Luanda, Angola; Malabo, Equatorial Guinea; Monrovia, Liberia; Nairobi, Kenya; Port Louis, Mauritius; Praia, Cape Verde; and Yaounde, Cameroon.

While dem go close down dia consulate for places like, Angola, Benin-Republic, Botswana, Burkina Faso, Burundi, Central African Republic, Chad, Madagascar, Sierra Leone, Malawi, among odas.

Trump administration don already reduce dia personnel for dis 20 embassies and consulates wey go remain open for Africa.

Visa processing in Africa don already dey difficult as many kontri dey face partial travel suspension.

Dis new rules mean say citizen of kontris wey no get di embassies or consulate go need travel to one of di 20 approved sites, bifor dem go fit travel.

Dis go further make travelling to US expensive for dis foreigners depsite say many African don already dey burden wit di hight cost.

And, di visa application process go become difficult and lengthy becos dem go need travel to oda countries or cities.

However, American citizens still fit renew dia passport and contact consulate for dia emergencies for dis kontris.

Last month, US announce say immigrants wey want green card go need leave US and apply for embassy or consulate wey dey dia home kontris.

Afta, US shutdown dis embassies and consulates, e go affect many foreign nationals wey dey live for US wit di hope of getting dia green card.

Many tok say dis policy go further families from each other as dem dey travel to oda kontris for dia application and e go di lengthy application process.