Adeleke sue EFCC for 2 billion naira afta Tinubu order anti-graft agency to comot hand from Osun account - wetin Peter Obi, Makinde tok

Govnor Ademola Adeleke and Oluwakuyode Olukoyede

Wia dis foto come from, Ademola Adeleke/X, EFCC/X

Published
Read am in 5 mins

Osun State Govnor Ademola Adeleke don sue di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) for 2 billion naira sake of how dem freeze di bank account of di state govment few days to di state govnorship election.

Earlier on Wednesday, di govnor bin announce say di EFCC don freeze di state account and call out di chairman of di anti-graft agency to explain why e freeze di account.

E bin promise to challenge di mata for court.

Dis court case dey come afta President Bola Tinubu order EFCC to comot hand from Osun account.

President Bola Tinubu on Thursday direct di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) to vacate di court order dem get to freeze Osun State govment account.

For one statement wey e personally issue on Thursday, Tinubu say im feel "deeply embarrassed no be bicos EFCC exercise dia mandate wey dey backed by court order, but by di timing of di agency action".

E order say make di commission stop whatever action dem get against di state govment.

Di Nigerian leader add say since e enta office, im don consistently maintain say anti-corruption and law enforcement agencies gatz dey allowed to discharge dia statutory responsibilities independently, professionally, witout fear or favour, or political interference.

E say sake of dat, im deliberately no dey chook mouth for dia operational activities.

Di president condemn di timing of di EFCC action as e say di time wey e happun go make pipo feel say di federal govment dey interfere wit di election.

"While I neva get full informate on di facts wey inform di action of EFCC wey make dem approach di court to obtain di said order wey freeze di Osun State govment account, I no get doubt say di timing of di action of EFCC dey inauspicious, and therefore I feel compelled to intervene."

Di Nigerian leader add say since e enta office, im don consistently maintain say anti-corruption and law enforcement agencies must dey allowed to discharge dia statutory responsibilities independently, professionally, witout fear or favour, or political interference.

E say sake of dat im deliberately no dey chook mouth for dia operational activities.

Wetin Peter Obi and Govnor Makinde tok about di mata

Former govnor of Anambra State Peter Obi say di timing of di freezing order dey suspicious as e happun for period wen election wan happun.

E say e no dey against fight against corruption but say make dem use due process to do am. Say dis action dey like dem wan use am as tool towards di upcoming election.

E add say growing perception dey say di anti-graft agency don dey turn to tool for di hands of politician, say dis na democracy and nobodi suppose suppress am.

Di presidential candidate of di NDC for Nigeria 2027 general elections say if evidence of wrongdoing dey, di constitution provide clear path: make dem seek di appropriate orders from competent court. No agency suppose exercise powers beyond di ones wey law grant.

“I dey call on all relevant authorities to act strictly within di constitution and ensure say notin dey undermine di credibility of Osun Govnorship Election," Obi tok.

Oyo State Govnor Seyi Makinde for im comments on X condemn di use of federal institutions to disrupt govnance for opposition states for Nigeria.

E say no govment dey above scrutiny but wen dem use institutions like di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to witchhunt specific states or public office holders, e dey indicate say dia investigations dey selective and dey comot public trust in di institutions.

”Di "freezing" of official state govment account witout due legal process pass di powers wey law give EFCC, di timing of di action suggests say na just anoda attempt by di federal govment to unduly influence di forthcoming govnorship election for Osun State,” Makinde tok.

E say make federal institution do di work law permit dem to do and make di rule of law prevail ova di rule of politics.

'Why we freeze Osun state govment account' - EFCC

Di kontri corruption police for inside one statement on Wednesday night say dem don dey torchlight di state govment since March ontop accuse of fraud wey relate to di tune of eleven billion naira.

"Di commission dey busy investigate di Osun state govment since March, 2026, ontop di alleged magomago way dem take handle Ecology Funds, Intervention Funds and Federal Account Allocation Committee (FAAC) account wey amount to di tune of 11, 000,000, 000 naira."

Dem add say some of di state govment officials, especially di Accountant General of di State, don get interview sessions wit dia investigators.

EFCC say dem no fit sidon dey look and watch as pipo dey milk di state govment account.

Dem also say even though dem know say govnorship election wan hold for di state, na dia responsibility to save di state money.

"While di Commission dey fully aware of of di upcoming govnorship election for Osun State, dem get responsibility to act in defence of di sanctity of di funds of di state. E no go dey nice for di Commission to use di excuse of di election to fold dia hands and not perform dia legally assigned functions."