As E Dey Happen, Osun governorship election live updates

Dis na di live update of di governorship election for Osun state.

Summary

  • Osun governorship election live updates
  • Who be di major candidates for di election
  • Wetin Inec dey tok about Osun
  • Nigerian musician Davido call on Trump

Live Coverage

Victor Ezeama and Tamara Ebiwei

  1. Who be di top candidates

    Ademola Adeleke (Accord), Bola Oyebamiji (APC), Najeem Salam (ADC), Adeagbo Yemisi (ADP)

    Wia dis foto come from, Facebook

    Wetin we call dis foto, Ademola Adeleke (Accord), Bola Oyebamiji (APC), Najeem Salam (ADC), Adeagbo Yemisi (ADP)

    Na 15 candidates dey contest for di election.

    Dis na even though sabi pipo tok say na about three of dis candidates get beta chance to win am.

    Out of di 15 candidates, only one na woman. Di main candidates na -

    Ademola Adeleke - Accord

    Bola Oyebamiji - APC

    Najeem Salam - ADC

    Adeagbo Yemisi - ADP

  2. Wetin to know about Osun election

    Logo of INEC polling Unit

    Govnorship election for Osun state don start across di 30 Local Govment Areas of di state.

    Dis na di 7th time dem go conduct govnorship election for di state since civilian rule return for 1999.

    Govnorship elections don happun for di state for 1999, 2003, 2007, 2010, 2014, 2018 and 2022.

    Di election na one of di off cycle elections wey dey happun across Nigeria. Dis na sake of court judgement wey bin remove one sitting govnor and install im opponent for di seat after three years.

    Di election go start by 8:30am and close by 2:30pm according to di Independent National Electoral Commission (Inec).

  3. Una welcome to our live coverage of Osun governorship election

    We welcome una to di live coverage of dis ogbonge election for Osun state.

    Dis na di last of di off cycle election for Nigeria wey dey always happun before di general election.

    Make una tanda wit us inside dis page for live updates of di election as e dey happun.