'My heart dey shattered' - wetin we know about di attack for Benue State wey kpai 13 pipo

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Police for Benue State northcentral Nigeria don confam say 13 pipo kpai for attack wey happun on Tuesday night for one community for di state.
Na for Efeyi community, Ugboju, Otukpo local govment area di attack happun.
Police say dem don start clearance operation for di community wey suspected bandits attack wey lead to di death of 13 pipo and 20 cattles wey di bandits alledgedly tiff.
For statement wey di Benue State Police Command release on Wednesday, tok-tok pesin, DSP Orchia Aondongu say di jaguda pipo enta di community and dia aim na to carry cattle wey one resident, Peter Ambulus get.
Police tok say "Preliminary investigation reveal say di armed bandits enta di community by force wit di sole intention of rustling cattle wey belong to one Peter Ambulus wey be native of di area."
"While dem bin dey escape wit di rustled cattle, di jaguda pipo open fire on farmers wey dem bin meet for bush.
"Regrettably, thirteen pipo lose dia lives during di attack, while di hoodlums successfully carry twenty cattle comot."
Tori be say di Commissioner of Police, Cletus Nwadiogbu, bin lead coordinated clearance operation alongside tactical teams as dem bin dey respond to di attack.
Di Command say even though dia personnel bin come under attack operatives came during di operation dem succeed to pursue di jaguda pipo and two of dem kpai.
"Wen di operation end, two of di suspected bandits dey neutralised, while one AK-47 rifle and fifteen rounds of ammunition dey recovered," police say for di statement.
According to police for Benue State, operation bin still dey go on, as security pipo dey check evriwia for di nearby forests and nearby communities to arrest di suspects wey dey on di run.
Police say dem go recover di cows wey di jaguda pipo tiff and di suspects go face di law.
'My heart dey shattered' - Village indigene
Ene Abu na indigene of Efeyi Utikpi for Ugboju, Otukpo Local Govment Area of Benue State wia di attack happun.
Im tell tori pipo say na around 5:00 a.m for early mor-mor wen rain bin dey fall small small na im dibjaguda pipo attack im village.
Im explain say even though im bin no dey for di village wen dis attack happun, pipo wey survive di attack for village, call am to tell am wetin happun.
"My heart dey shattered! Armed men wey dem believ say na herders bin storm our small farming community in large numbers. As day dey break, di villagers fit see di attackers clearly, but dem bin dey helpless. Dia only chance of survival na to run for their lives."
Im add say many pipo still dey miss as di attackers burn some houses down to ashes.
"Dem tiff livestock Families don lose evritin wey dem get. Children no get dia parents again, and parents dey mourn dia children.
Efeyi Utikpi no be community wey dey known for violence. We dey peaceful, hospitable, and hardworking peasant farmers wey our only desire na to live in peace for our ancestral land."
According to am, e neva tey wey dem attack Otukpo Onobi, anoda community for Otukpo Local Government Area.
"Today, (Tuesday) na our turn. We dey fear say if urgent action no happun, more innocent communities go kontinu to suffer."
Chairman of Otukpo Local Govment Area, Maxwell Ogiri wey also confam say di attack happun, tell local tori pesin say "I even dey Teaching Hospital expecting di pipo wey wound.
"Some of dem bin dey local hospital for first aid but I no sure say dat place go dey too good enough for dem."
Im explain say notin like provocation happun di herders just dey attack different communities anyhow recently.
And im as di local govment chairman dey ty to comfort dem and give dem wia dem go stay and oda logistics.
Benue State Govnor, Hyacinth Alia, don react to dis fresh attack for di state.
For statement wey im Chief Press Secretary, Tersoo Kula release, govnor Alia tok say di blood of pipo wey kpai, di pain wey dia families dey pass through, di trauma of di pipo wey survive and di losses wey dem dey face need compassion and sharp-sharp action wey go unite di pipo scoring.
Im add say dis no be di time wey politicians go dey use kasala for dia political benefit.
"For moment like dis, wetin our pipo expect and deserve na responsible leadership and constructive oversight," e tok for statement.
Alia match leg for ground as imtok say im administration go kontinu to support security agencies through logistics, how to share intelligence , tins wey go security pipo and collabo wit local vigilante pipo.
"Govnor Hyacinth Alia administration dey consistently provide tangible support to security agencies through logistical assistance, intelligence collaboration, personnel motivation and coordination wit local vigilantes to protect communities and restore peace," di statement add.










