Nigerian Army appoint General Officers Commanding for new divisions

Wia dis foto come from, Nigerian Army/X
Di Nigeria Army don approve di appointment of General Officers Commanding (GOCs) to di newly established Army Divisions, as di military expand dia command structure to strengthen operations across di kontri.
Dis new appointments dey come afta President Bola Tinubu recently approve di creation of four additional Nigerian Army divisions as part of effort to strengthen di kontri security structure and improve how di military dey carry out dia operations.
Di Chief of Army Staff (COAS), Lieutenant General Waidi Shaibu wey approve di appointments say di new formations go immediately commence operations for di respective locations, afta dem get di Initial Operational Capability, as dem go take deliberate measures to achieve Full Operational Capability (FOC).
Tok-tok pesin for di Nigerian Army Colonel Appolonia Anele announce dis informate for one statement on dia official X account on Wednesday, 29 July.
Na on 23 July, Presido Tinubu approve make Nigerian Army expand from eight divisions to 12 divisions.
Here na di names of di new GOCs:
Major General Yakubu Yahaya - new GOC for 9 Division Ilorin, and na also commander of Operation Savanna Shield, di military operation to fight terrorist elements wey dey disturb for di North Central states of Kwara and Niger.
Major General Chinedu Ralph Nnebeife - new GOC 10 Division Jalingo.
End of Di one wey oda users dey read well well
E bin dey serve for di headquarters 2 Division/Sector 3 Joint Task Force (North West), Operation Fansan Yamma wey dey tackle bandits for di Sokoto and Zamfara axis of di Northwest region of Nigeria.
Major General Moses Gara - new GOC 5 Division Makurdi. E go also serve as di commander of di Joint Task Force Operation Whirl Stroke wey be di military operation combating insecurity for Benue State and di surrounding areas.
Major General Auwalu Mahmuda - new GOC2 Division, Ibadan. E bin dey ser for di Army Headquarters Directorate of Inspection and Compliance.











