Anoda Nigerian death for South African police operation create gbege

Nigerians for front of High Commission for South Africa for voluntary repartriation

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images

Published
Read am in 3 mins

One Nigerian national, Ibeh Chika Simon don kpai for South African police hand for one South African Police Service Operation wey happun for 23 July for Cape Town.

Dis informate dey come from di Consulate General of di Federal Republic of Nigeria for Johannesburg wey condemn im death wey dem bin call say happun under "questionable circumstances".

For office of di office of di Consulate General, dem tok say "we dey deeply appalled by tori of di shocking police tactics wey cause im death plus including di shooting of anoda Nigeria, Egwabor Patrick Chuks wey still dey in treatment wit plenti injuries".

Dis na di second death of Nigerian for police hand wey dey confam since South Africans start to protest say make foreign Africans comot dia kontri.

Na di Nigerian Foreign Ministry bin loud dat issue say police officers for Tshwane Metro Police kill Emeka Charles Iroegbu for Pretoria on 28 June "using gruesome interrogation techniques".

Dem say for 28 April dem still kpai anoda Nigerian, Nnaemeka Ekpeyong. and di Ministry add say, "Im case still dey pend, dem no make any arrest, even though di four officers wey dey involved dey known to di South Africa Police Service (SAPS)".

Di Consulate reason di mata say "inside di growing afrophobic sentiment, dis kain tin show disturbing disregard for right to life, dignity and due process wey di South African Law Stamp for all human beings."

Videos of di mata as oga Simon dey kpia show wetin look like say police dey strangle am.

All dis dey happun as plenti Africans don dey try to comot dia citizens from di kontri following deadline of 30 June wey di protesters against immigration give immigrants for di kontri.

Even sef di mata don pass govment to tell South Africa to investigate dis killings.

Two Ghanaians don petition di international Criminal Court (ICC) to chook eye for di xenophobic attacks against foreign nationals for South Africa.

According to dem, dis attacks wey don cause deaths, injuries and looting of shops be crime against humanity, under Article 7 of di Rome Statute.

Dr Palgrave Boakye Danquah wey be ex-Ghana govment tok-tok pesin on governance and security togeda wit security sabi pesin Emmanuel Kotin, bin petition di ICC on 15 July, wey dem demand among oda tins say South Africa authorities gatz take serious action now.

Inside di petition to di office of di prosecutor of di ICC for di Hague, Dr Palgrave and Emmanuel Koti say "di ICC gatz begin preliminary examination into di repeated xenophobic attacks for South Africa wey cause illegal killing s, assault, displacement and destruction of property wey belong to civilians and foreign nationals especially African migrants."

According to Reuters, one tok-tok pesin for South Africa foreign ministry say di petition be opportunistic, wia im tok say e fail to meet di legal jurisdictional requirements for di ICC to act.

Di ministry toktok pesin Chrispin Phiri say "South Africa get sophisticated and domestic legal framework" wey dia laws dey provide comprehensive solution and enforcement against discrimination, intolerance and odas.