'25 pipo kpai and dem bury dem for captivity, snake bite three pipo' and oda tins wey victims say happun to Kwara State abductees

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Makuochi Okafor
- Role, BBC News
- Published
- Read am in 4 mins
Fresh details don emerge about di release of 308 pipo wey Nigerian authorities say dem rescue from kidnappers den.
Dis latest release na wetin dem describe as di kontri "largest single-day operation" wey involve joint security forces.
Among dose wey dem release na 163 pipo from Nigeria north-western Kwara State, wey kidnappers abduct during February attack on two communities for Kaiama district, Woro and Nuku.
Kwara State lawmaker Abdullahi Halidu Danbaba, wey dey represent Woro constituency, tell di BBC on Thursday say some of di victims describe di kain harsh conditions dem experience while dem dey for captivity.
"Dem go through veri difficult ordeal. One woman say three pipo dey bitten by snakes. She also say about 25 pipo die for dia and dem bury dem at di location," e tok.
Di released group include women, children and elderly pipo, many of dem dey for poor health.
Danbaba say afta di victims arrive for Ilorin, di state capital, "about 40 pipo dey rushed to di hospital for medical attention".
Dem take di victims first to military facility for neighbouring Niger State, wia dem receive medical attention, bifor dem hand dem ova to di Kwara State govment to reunite wit dia families.
Di victims dey among more dan 100 pipo wey dem abduct for February wen armed attackers storm di two communities on motorbikes.
Di attackers, wey authorities decribe as jihadists wear military-style uniforms, kill more dan 100 pipo during di assault.
Amnesty International say dem find some of dose killed wit dia hands and feet tied, while dem shoot odas or dem don cut dia throats.
Videos released by di kidnappers weeks afta di attack show several women and young children, including toddlers, among dose wey dem hold.
Danbaba say women bin give birth while dem dey for captivity and return wit dia babies.
"Two women bin give birth for captivity and return wit dia babies witout any proper medical care," e tok.
E add say "some of di older pipo among dem help take care of di babies".
Di lawmaker say di victims tell am say dem "give dem food only once a day".
Danbaba also say some teenage boys remain for captivity.
Di presidency wey first announce di release no disclose dis part of di tori.
"E also get some young boys between di ages of 13 and 15 or 16 wey dem no release. Dem still hold dem for dia."
According to di victims, di lawmaker say kidnappers dey plan to recruit dem into dia group.
Di Nigerian govment don blame Boko Haram militants for di attack, saying di communities dey targeted for refusing to accept strict interpretation of Islam.
Afta di attack, Amnesty International say di militants dey distribute leaflets for di two villages for several months bifor di killings.
Danbaba say e remain unclear how di authorities secure di release of di victims.
"Di only tin we know na say dem don rescue dem" e tok.
E say di community don "already give up hope" afta months of uncertainty since di attack on 3 February.
"We dey grateful to our Govnor, AbdulRahman AbdulRazaq, di President, Bola Ahmed Tinubu, and di security agencies wey make efforts to rescue dem."









