Official songs for di 2026 Fifa World Cup

Collage foto of Shakira, Lisa, Davido, Tyla and Burna Boy.

Wia dis foto come from, Gilbert Flores/Billboard via Getty Images, Jamie McCarthy/WireImage, Paras Griffin/Getty Images, Mike Marsland/WireImage

Published
Read am in 5 mins

Fifa don release di official album for di 2026 World Cup.

Di album don bring togeda all artists across di world, wit different musical backgrounds to produce songs wey many cultures across di world dey vibe wit di sound and rhyme on dis tracks.

Fans across di world go enjoy di 18 tracks live for Mexico City, Toronto and Los Angeles, during di official opening ceremony for di three kontris, Mexico, Canada and United States.

Some of di popular artists for di Fifa album na Major Lazer, Nelly Furtado and Davido on 'No Place Like Home,' Shakira and Burna Boy on 'Dai Dai,' IShowSpeed on 'Champion', Lisa, Anitta and Rema on 'Goals'.

Fifa President Gianni Infantino tok say dem don bring togeda international fans through di shared languages of football and music.

"Fifa don bring togada strong music squad and wey fit match di biggest single-sport event for history," e tok

"From global superstars to breakthrough voices wey don shape di future of music, di Official Fifa World Cup 2026 Album feature artists from across continents, languages and genres, to bring fans worldwide through di power of music and football."

'Champion' – IShowSpeed

Foto of American YouTuber IShowSpeed wen e attend di 2025 Algerian Super Cup Final

Wia dis foto come from, Bille Bensalem/APP/NurPhoto via Getty Images

IShowSpeed drop di football anthem "Champions" on Monday and di video don hit 16 million views on YouTube and over 80 million on X, immediately fans don dey share am across every platform.

IShowSpeed shoot di video for Miami, di video feature Speed for stadium-inspired settings wit different national flags, colored powder and strong Ghanaian cultural influences. E also wear Cristiano Ronaldo official Portugal jersey throughout di video.

Di track show as participating nations dey jubilate ova di beat for di stadium. Many fans also join in di video wit dia jersies as dem dey echo di song.

Afta di Video, Fifa reach out to Speed on Instagram say dem don add di song to di official list of 2026 World Cup songs.

"We don hear am. We like am. E dey on di Official Fifa World Cup 2026 Album," Fifa tell am.

'No Place Like Home' – Major Lazer, Nelly Furtado and Davido

Davido dey perform on di Gobi Stage during weekend 2, of Coachella Valley Music & Arts Festival on April 18, 2026.

Wia dis foto come from, Scott Dudelson/Getty Images for Coachella

Nigerian Afrobeats star Davido team up wit global music group Major Lazer and Canadian singer Nelly Furtado to drop new exicting global anthem, "No Place Like Home (Fifa World Cup 2026)".

Di track na mix of Afrobeat, pop, and dance sound wey create energetic anthem wey dey focus on celebration, unity, and worldwide football excitement.

Davido melodious voice and energetic vibe make di song fun.

"No Place Like Home" na di kind of anthem wey fans fit sing during football celebrations, watch parties, and major sporting moments.

Di collaboration between Davido, Major Lazer, and Nelly Furtado create dis beautiful song wey pipo worldwide fit relate wit while e still maintain Afrobeat flavor.

'Dai Dai' – Shakira and Burna Boy

Burna Boy dey perform during in tour for Atlanta, Georgia

Wia dis foto come from, Prince Williams/WireImage

Wetin we call dis foto, Burna Boy dey perform during in tour for Atlanta, Georgia

Last month, Colombian pop star Shakira announce her official song for di 2026 World Cup featuring Nigeria Afrobeats star, Burna Boy has dem unviel "Dai Dai," as di anthem for di 2026 World Cup.

'Dai Dai' na mix of Afrobeats and Latin pop vibes, e dey centre on unity, harmony, strong ambition among kontris.

Di artistes also give shout out to football legends like Pelé, Diego Maradona, Paolo Maldini, Romário, Cristiano Ronaldo, Andrés Iniesta, David Beckham, Kaká, Lionel Messi, Kylian Mbappé and Mohamed Salah.

Di song na about football-loving kontris like Brazil, Argentina, Uruguay, Colombia, England, France, Germany, Spain, Mexico, Japan, South Korea, South Africa and di United States.

Di 49-year-old wey be di star on di songs like Whenever, Wherever and Hips Don't Lie bin announce say she go drop Dai Dai on Thursday, 14 May as di anthem for dis year World Cup wey go dey jointly hosted by di US, Mexico and Canada.

Dis go be Shakira second official World Cup anthem afta 'Waka Waka' wey she run for 2010 World Cup wey hapun for South Africa.

She bin also work for di 2014 tournament wit di song La La La (Brazil 2014) wey she perform for di end of di ceremony for Rio de Janeirp.

'Goals' – LISA, Anitta and Rema

Rema dey performs at di 2025 Global Citizen Festival wey hold for Central Park on September 27, 2025 in New York.

Wia dis foto come from, John Nacion/Billboard via Getty Images

Nigeria Afrobreat star, Rema, LISA, and Anitta don come togada to bring di Africa, Asia and Carribean mix into dis single song.

Dis collaboration na di perfect blend of talents from three different continents, wey go connect fans at di tournament.

Di song dey mix global sounds, come blend Afrobeats ginger, Latin pop rhythm, and K-pop vibe, all to create di anthem wey dey ready for celebration, energy, and worldwide connection.

Rema na one of di rising star for Africa, e bring im melodic vibes and young charisma on dis track.

LISA dey among di power all female group 'BlackPink' also perform energetically, while Anitta deliver her Latin pop wey appeal to all global audience.

Dis collaboration na more dan just soundtrack — na meeting point for continents, fanbases, and musical worlds.

All 18 tracks on di album

  • Goals– LISA, Anitta and Rema
  • Game Time– Future and Tyla
  • Illuminate– Jessie Reyez and Elyanna
  • Echo– Daddy Yankee and Shenseea
  • Por Ella– Los Ángeles Azules and Belinda
  • Three Nations – 21 Savage, Nata Cano and French Montana
  • No Place Like Home– Major Lazer, Nelly Furtado and Davido
  • In the Stars (Remix) – The Rolling Stones
  • Show Me– Ayra Starr and Latto
  • Mi Mexico Lindo– Alejandro Fernández
  • Blessings– Stormzy, Fridayy and Angel
  • Energy – Ava Max and BIA
  • Lighter– Jelly Roll and Carín León
  • Siir Siir– Nora Fatehi, Vegedream and Sanjoy
  • Partidazo– Danny Ocean
  • Champion– IShowSpeed
  • Love Always Wins– Shaggy, Cimafunk and Zema
  • Dai Dai – Shakira and Burna Boy