Who fit win Golden Boot for 2026 Fifa World Cup

Drawing wey dey show photographs of Kylian Mbappe as im dey run wit di ball and Harry Kane wey dey look.

Wia dis foto come from, BBC Sport

Wetin we call dis foto, Kylian Mbappe and Harry Kane dey aim to becom di first player to win di Golden Boot two times.
    • Author, Flora Snelson
    • Role, BBC Sport journalist
  • Published
  • Read am in 7 mins

Kylian Mbappe no fit smile as im bin collect im Golden Boot trophy wen di 2022 World Cup bin end.

France bin lose di final, even though im bin score hat-trick. Goals no dey guarantee prizes, but na beta striker dey give im team di chance.

As di next edition of di biggest football tournament for di world dey deaw closer, we dey chook eye for di common qualities wey Golden Boot winners suppose get and tok about some of di leading candidates wey fit finish as top scorer for 2026.

Split image wey dey show foto of Oleg Salenko, Harry Kane and Davor Suker

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Na Oleg Salenko (left) win di Gold Boot in 1994, Harry Kane (middle) win am for 2018 and Davor Suker (right) win di 1998 edition.

Old players no dey usually apply

Some bad news dey for Harry Kane - history suggest say e dey unlikely for di 2026 Golden Boot winner to dey 30 years or above.

E don only happun once, wen Davor Suker bin score six goals wen im bin dey 30 years for France '98 as Croatia bin carry third for dia first World Cup since dem get independence.

Suker na di exception to di rule. On average Golden Boot winners dey 24.7 years old. Mbappe bin bring di average down small for 2022, di 24-year-old beat 35-year-old Lionel Messi tally by just one goal.

Di record for di youngest player to claim di Golden Boot - wey 18-year-old Lamine Yamal fit dey look wit corner eye - dey for Hungarian Florian Albert hand, na one of di six joint-winners for Chile 1962 and im bin dey 20 years and eight months old.

You no fit do am alone

Striker wey go dey successful need two tins - good supply line and for dia team to go far for di tournament. And e no dey surprising, diafore, five-time winners Brazil bin don produce six of di ogonge strikers for di tournament.

Dia first Golden Boot winner na Leonidas in 1938 and dia latest na Ronaldo in 2002.

Beta group stage na good start for pipo wey dey hope to win di Golden Boot , but if your team no qualify from di group and progress to di knockout stages, you get disadvantage already.

Na wetin bin happun to Cristiano Ronaldo for Russia 2018. Im bin score four goals for Group B goals bifor Portugal comot for di Round of 16, while Kane bin score six times as England bin reach di semi-finals.

No be evritime e dey happun as exception dey - Oleg Salenko for USA '94. Im finish im work, by di time im bin enta flight dey go back home afta Russia fail to progress from Group B, becos im bin score five goals for di 6-1 thrashing of Cameroon and six goals overall give am di Golden Boot.

Start early from your club

Thomas Muller bin neva score for im kontri bifor in land for South Africa for di 2010 World Cup.

"I basically bin dey lucky, I hit form at just di right time," Muller tok as im carry di Golden Boot.

For 2009-10 Bundesliga season, Bayern Munich bin wan send Muller out on loan or even sell am.

However Louis van Gaal land for di club arrived and from nowhere im start to play regular football for di team.

Muller bin score 13 goals and provide 11 assists as im begin play evri game for Bayern league-winning campaign, na wetin land am for di World Cup wen im bin dey beta form and dey hot well-well sake of im successful season for im club.

Im story na familiar one among Golden Boot winners. Only two times wey player from club wey finish outside dia domestic top four finish as di World Cup top scorer.

Try to sabi play any position

Muller beat more experienced players to win di prize for 2010 - wit only small chance.

Di 20-year-old and Diego Forlan of Uruguay score one goal goal each for di third-place play-off to tie David Villa of Spain and Wesley Sneijder of Netherlands on five goals.

Villa and Sneijder bin get di chance to claim di boot for di final for Johannesburg but two of dem no score and dem need to separate four of dem by di number of assists wey dem provide.

Muller tally of three na im decide who win am.

And if you dey wonder wetin go happun if players tie on goals and assists, Fifa dey give di Golden Boot to di man wey play di fewest minutes.

Who be di 2026 Golden Boot favourites?

Nobody don win di World Cup Golden Boot more dan one time - but two men get beta chance to becom di first to do so dis summer.

Mbappe bin score four goals for di World Cup qualifying-round and as one of di strongest squads for di tournament, e dey likely say 2022 finalists France go reach di latter stages of di competition.

Anoda striker wey dey seek historic second boot na Kane. At 32, as we know.im dey significantly older dan di average winner - but wit 54 goals for im club dis season, Kane no be average player. If Thomas Tuchel side go fit reach near di end of di tournament, e sure for Kane to score im fair share.

Messi bin don win plenti personal award for im career, but di Golden Boot go shape di gap wey dey for im cabinet afta im eight Ballon d'Or trophies. At 38, di 2026 tournament na im final chance.

On di oda end of di age scale, Lamine Yamal go be 19 years di week bifor di final. Spain neva progress beyond di round of 16 since dia 2010 tournament wey dem win, but Luis de la Fuente men bin show say dem get di mind to go all di way for di Euro 2024 and dem bin play well for di qualifying round.

Premier League Golden Boot winner Erling Haaland don score 26 league goals for Manchester City dis season but im hope to win di boot fit depend on how long Norway stay for di tournament. Haaland bin score 16 goals for di eight qualifying games.

Di only player wey bin score more dan 100 goals for four different clubs and im get successful season for Saudi Arabia na Ronaldo and im go dey chook eyes for di Golden Boot even though im dey 41 years old.

Portugal record of just one World Cup knockout win since 2006 no stand well for am, but dem get strong squad - including assist king Bruno Fernandes - and- dem get evri chance to reach di latter stage of di World Cup.

Inside Real Madrid season wey get plenti kasala, 25-year-old Vinicius Junior bin score 21 goals and im bin assist 14 times across all competitions. But afta im finish fifth for di Conmebol qualifying round and wit im squad wey still dey relying on older players, Brazil fit struggle to give Vinicius di platform to hustle for di Golden Boot challenge.

Ousmane Dembele no enjoy di same outstanding season as 2024-25, but im still manage to score 19 times for all competitions for Paris St-Germain. France get plenti attacking options but Dembele dey likely to be one of dia regular attackera and im fit easily compete wit im fellow kontri man Mbappe for di boot.

Argentina fit get two more challengers to add wit Messi, Lautaro Martinez and Julian Alvarez nastrong candidates. Martinez score di winner for di final and im bin earn di Golden Boot wit five-goals for di Copa America 2024 while Alvarez na one of di ogbonge stikers for Europe afta a fine season wit Atletico Madrid.

Di outsiders

Doz ones na di more predictable candidates, but make you no surprise if some surprises show up for di for boot challenge.

Euro 2024 final match-winner Mikel Oyarzabal score for all but one of Spain World Cup qualifying games and in also score 15 La Liga goals dis season. If injuries allow am, im go get Lamine Yamal and Nico Williams wey go give am plenti chance.

Alexander Isak fit comeback fresh afta im injury-hit season wit Liverpool and shine for Sweden? Or im compatriot Viktor Gyokeres fit be a candidate?

Raphinha season to no dey smooth sake of injury but im be serious attacking threat and fit play for Brazil forward line alongside Vinicius and Igor Thiago, anoda potential boot winner.

Michael Olise go enta di tournament afta im score 22 goals dis season for all competitions for Bayern. Although im na ogbonge assist machine, wit 30 assists for di German champions dis season, France go create so many chance wey fit make am boot contender too.

Finally, wat of anoda relative veteran, Romelu Lukaku? Belgium get plenti creative players for dia team and di Napoli forward fit no fit play somtimes , so iim be di kain player wey fit get one beta group game den add one goal or two more for di knockout stage.