African kontris issue alert to citizens ahead of June 30 deadline for migrants to leave South Africa

African countries are issuing alerts for their citizens

Wia dis foto come from, MALAWI GOVERNMENT

Wetin we call dis foto, Malawi govment still dey send buses to comot dia citizens wey dey stranded for one camp for Durban
Published
Read am in 7 mins

Wit days to di 30 June deadline for all African migrants to comot South Africa, some kontris dey issue alerts and warnings to dia citizens.

Vigilantes and anti-immigration groups dey kontinu dia protests across di kontri to put pressure for black foreigners to comot South Africa.

Di wave of xenophobic attacks already force some pipo to abandon dia homes wey dem bin dey find shelter for churches, schools and oda places.

Some migrants bin dey stranded for camps for Durban for weeks wey dem dey call for help for dia kontris.

African migrant shop owners still dey face harassment wey dia shops dey suffer looting and shutdowns.

Di 'March and March' movement wey dey lead di anti-immigration protests since April, say any African migrants wey remain for dia kontri afta di 30 June deadline go blame diaserf.

In fact, leaders of di groups storm some communities wey dem warn migrants say "di fact say we bin give 30 June deadline no mean say you go stay until dat day, make you comot now."

Police meet wit leaders of anti-immigration protest ahead of 30 June

South Africa has consistently said it does not condone attacks on foreigners

Wia dis foto come from, SOUTH AFRICA POLICE SERVICE

Wetin we call dis foto, Police say dem warn protest leaders against looting, attacking and harming pipo for dia 30 June nationwide protests

Inside one statement, South African police tok say dem bin meet to discuss how to keep di kontri safe on di day of di 30 June nationwide protests and beyond.

"Di meeting between di parties don gree say di province go dey safe, wit no violence and criminality during di 30 June protests," di South African police tok.

Dem add say "di group gree say nobody go loot shops for dat day and beyond."

Phakhel'umthakhathi, wey dey lead di 'March and March' protests tok say dem go cooperate wit law enforcement.

Im assure leadership of di police say im dey lead disciplined men wey dey listen to di command of dia leaders for dis protests.

"Dis na our kontri wey we gatz fight for di well-being. Our pipo gatz dey first, we sabi say violence no go solve our problems. Our own na to hold di govment accountable to ensure say pipo wey dey stay for our kontri dey legally allowed to do so, wey dem for respect di rule of law," Phakhel'umthakhathi tok.

Im add say " all we want be say make our brothers and sisters for oda kontris enta South Africa legally wey dem for no feed our pickins wit drugs or commit crimes."

Provincial Commissioner of KwaZulu-Natal, Lieutenant General Nhlanhla Mkhwanazi tok leaders for di protests say "we all want illegal foreigners to comot sake of to dey stay hia illegally na crime, dat be why we dey arrest plenti undocumented foreigners every day."

"However, no amount of crime dey call for attack on anoda pesin wey fit lead to dia death. Patriotism gatz lead to accountability from di govment, no be to dey destroy property. Police no go stop any protests wey we go ensure say pipo wey march, go do so without fear," Lieutenant General Nhlanhla Mkhwanazi add.

Police authorities say dem go deal wit crime as crime according to di law.

Kontris issue alerts and warnings

Anti-immigration protests began in early April and have been ongoing since

Wia dis foto come from, MALAWI GOVERNMENT

Wetin we call dis foto, Kontris dey work overtime to ensure say dem evacuate as many citizens as possible bifor di 30 June deadline wey vigilante groups bin give foreigners to comot
  • Ethiopia

Di Ethiopian Foreign ministry say dia embassy for South Africa dey monitor di situation ahead of di 30 June nationwide protests.

Inside one statement di kontri foreign ministry say "di South Africa govment say dem go provide protection for all places to prevent violent attacks on refugees wey dem go use di law to deal wit all di issues."

"But we don pick up trends say some of di protesters go still do illegal tins and attack refugees. Di embassy dey warn make Ethiopians for di kontri dey careful of dia daily activities."

"Sake of some of dis threats, we dey advise our citizens to maintain contact wit local govment agencies and community organizations and report anytin to di embassy officials."

  • Malawi

Malawi authorities don relocate di reception center for processing dia citizens wey dey run from xenophobic attacks, from Kamuzu Stadium for Blantyre to Joyce Chitsulo stadium for Mwanza.

According to di govment dis relocation na to create one reception and processing center wey dey close to di border.

"Dis go enable citizens wey don dey return to access key services like immigration clearance, registration, health screening and humanitarian assistance for one location when di returnees arrive," di govment announce for dia statement.

Dem also clarify say "to reduce di pressure on di returnees, relief supplies and teams dey for Mwanza. We go give dem transport fare from Mwanza to dia home districts."

Dem also assure say dem go continue to support dia citizens wey dey for camp for Durban, as di repatriation process still dey go on.

Di govment as citizens wey still dey in danger to contact officers for dia consulate for assistance.

this is the first time countries have taken out their citizens from south africa due to xenophobic attacks

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, Ghana say more pipo register for voluntary repatriation afta dem return almost 1,000 pipo to di kontri
  • Ghana

Afta Ghana authorities evacuate di third batch of citizens from South Africa on 7 June, di kontri no announce any more plans for evacuation.

Nearly 1,000 citizens don return to di kontri for three batches.

But wit di 30 June deadline wey dey approach, some citizens wey still dey di kontri dey wonder wetin go happun to dem.

Local media report say Ghana dey work to evacuate more pipo bifor di nationwide 30 June protests.

Ghana high commissioner to South Africa Benjamin Quashie tok for Joy FM say more pipo don dey register for evacuation.

"Togeda wit di govment and di foreign affairs ministry, we dey work towards ensuring say di citizens go return safely to Ghana probably bifor di 30 June deadline for dis demonstrations."

Authorities say dem dey monitor di situation wey dem go ensure di safety and welfare of Ghanaian citizens.

  • Nigeria

Nigerian bin return 66 citizens for di second batch afta di first 300 plus pipo return early dis month.

Nigerian Acting High Commissioner for South Africa Alexander Ajayi say dem get some challenges wey affect di first batch, but dem dey work to return as many citizens as possible.

"Govment dey do everitin possible to ensure all Nigerians go return safely. South Africa govment assure us for di diplomatic community say di 30 June deadline no be from govment, make we no fear."

Oga Alexander Ajayi explain on top local network News Central say "we don meet wit di South African govment wey dem assure us say nobody go harm our nationals afta dis 30 June deadline by di vigilantes. We go take dia word for it".

"South African authorities say dem put tins in place to ensure di safety of our nationals and oda foreigners for dia kontri."

Nigerians wey dey stay for South Africa dey advised contact embassy officials wit information wey dem gatz stay away from protest areas during di marches.