'Pipo dey stranded, dey sleep for street' - Nigerians in South Africa lament ahead of June 30 deadline

Large numbers of men gada wit sticks

Wia dis foto come from, Darren Stewart/Gallo Images via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Nigerians wey dey South Africa dey complain say dem dey stranded for di High Commission office as dem dey wait for Nigerian govment to evacuate dem bifor di June 30 deadline.

For video wey show face for social media, some di stranded Nigerians follow tori pipo tok on how dem dey struggle to feed for di High Commission.

Nigeria govment bring back 268 citizens from South Africa sake of xenophobic attacks for di kontri, for mid June.

Di pipo wey return to Nigeria na part of around 1,000 pipo wey di Nigerian consulate for South Africa say dem register to return home.

Di first batch of Nigerians wey govment dey comot for South Africa land for Murtala Muhammed International Airport for 11 June, 2026, and dem expect more evacuation.

But afta di first evacuation, we neva hear tori of anoda set of Nigerians wey di govment comot for South Africa.

Kontris like Ghana, Zimbabwe and Malawi don already carry out evacuations, ahead of di 30 June deadline wey some campaigners set for undocumented migrants to leave South Africa.

'So many pipo dey sick' - Nigerian in South Africa

One Nigerian, Christian Onyenweaku, wey tok to local media News Central nsay pipo dey sick for di High Commission office wia dem dey.

E say di situation dey painful and Nigerian govment no fuilfil di promises wey dem make.

"Pipo dey stranded sleeping on di street. So many of dem dey sick, if you go inside you go see so many of dem wey dey sick becos fo di situation."

"E dey so embarrassing, e dey painful. Dem dey promise us today, anytime dem promise us, dem dey always fail."

According to di Nigerian, e say dem no see food cchop if no be some churches and organisations wey dey help dem.

"Right now, to see food to chop dey difficult, if no be for some pastors from Nigeria wey come wit some food and some oda organisations wey make sure say dis pipo get food."

'No pesin suppose carry dangerous weapons or firearms' - Police

South African Police say dem no go watch make anybody carry weapon during di June 30 planned protest against illegal migrants.

Di police say dem dey ready across all di eight districts for South Africa and go deploy law enforcements ahead of di protests.

Provincial Commissioner for Eastern Cape, Lt Gen Vuyisile Ncata, say dem no go allow any act of violence during di protests across di South Africa.

"While we acknowledge and respect di constitutional right of citizens to engage in peaceful demonstrations, we no go allow any act of lawlessness, violence, intimidation, or criminality," Lieutenant General Ncata say.

"We also call on organisers of marches to play dia part by discouraging participants from carrying weapons or engage in conduct wey go provoke violence or place odas at risk."

Police say dia officers go stand gidgba to enforce di law and dem go take necessary actions against anyone wey dem catch wey violate di law.