Fort Hood shooter go dey executed by firing squad for first time for US military since World War Two

Wia dis foto come from, Bell County Sheriff's Office via Getty Images
- Author, Sareen Habeshian
- Published
- Read am in 3 mins
Di Pentagon don announce say dem go execute one former US Army major wit firing squad. Dis go be di first time dem go do dis kain military execution in ova 60 years.
Nidal Malik Hasan bin shoot and kill 13 unarmed US sojas for Fort Hood for 2009, and wound 32 odas.
Di Pentagon tok-tok pesin, Sean Parnell bin announce dis informate on top social media on Monday say na Secretary of War Pete Hegseth recommend am and President Donald Trump na im approve am.
Na di first time dem go do military execution wit firing squad since di end of World War Two.
Parnell tok say di secretary of di Army go set di time and place for di execution.
E write for X tok say, "Judgement day for Hasan don finally come".
Hasan wey bin dey work as US Army psychiatrist from Virginia bin kpai 13 sojas for di base wey dey Texas for 2009 and later tok for court say na im be di gunman true-true and say sorry for "any mistakes".
E tok for im court-martial for 2013 say e bin tink say e bin dey protect Muslims and di Taliban for Afghanistan.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di killings for 5 November 2009 na di deadliest eva wey come from non-combat attack for American military base.
Di attack bin happun for one crowded medical building wia sojas wey dey deplyed bin dey wait for check-ups and vaccines.
Hasan now na one of four inmates wey dey for di US military death row.
According to military law, to do military execution need approval from di US president.
E also need appellate review and final judgement say e dey legal for am to move forward.
Di US Court of Appeals for Armed Forces bin call di military death penalty unconstitutional for 1983. But di US President dat time wey be Ronald Reagan put back an bak wit executive order just di next year.
Military executions dey different from di ones wey dem dey do for state level.
Most of di executions for di US na state level dey run am. Dis na as 27 states, di military and di federal govment still get capital punishment as legal option.
But death by firing squad no dey common. Dem use execution by firing squad last year for South Carolina, dis na di first time di state use am and di first time wey dem dey use dat kain way to kpaipesin fior di US in 15 years.
Four oda states dey allow firing squad, including Idaho, Mississippi, Oklahoma and Utah.
Trump don be supporter of di federal death penalty and bring am back wit executiove order on di first day of im new administration for January 2025.
Under di former President Joe Biden, di justice department bin match break on di federal use of death penalty.
Di executive order wey Trump sign say capital punishment "na important tool to take prevent and punish pipo wey fit commit di most terrible crimes and acts of lethal violence against American citizens".
























