Ghana 2 - 3 Gambia 2027 Afcon qualifier live updates

ghana is racing against time
Wetin we call dis foto, Ghana take 2-0 lead for di first half bifor Gambia score 2 quick goals in 6 minutes to equalise bifor halftime
Published
Read am in 12 mins

Second Half

86" Anoda freekick for di Gambia area. Ghana take am quick bifor dem spoil am. Goalkick.

85" Freekick to Ghana for di edge of di Gambia box. Gideon Mensah take di freekick and Ghana don waste am.

84" Ernest Nuamah comot di game for Christopher Baah Bonsu

Chaaance! Felix Afena-Gyan get one chance afta Jonas Adjetey play long ball over di top. Benjamin Tetteh collect di ball into di path for Afena-Gyan but im shot enta Row Z. Wasted chance.

83" Di Scorpions dey put every body behind di ball to defend for di last minutes

82" Time dey run out for Ghana to rescue one point from dis game.

Chance! Fatawu Issahaku find di ball inside di Gambia box and shoot on target. Baboucar save am.

81" Three corner kicks in less dan one minute but di Black Stars waste all of dem. Gambia dey defend well.

Dem win anoda corner afta poor kick by Fatawu.

80" Corner to Ghana. Fatawu don drive di ball for di byline and win di corner

79" Chaaance! Nuamah swing im shot way off target when im dey unmarked inside di Gambia box. Easy chance to score, but di Lyon playwer don waste am.

Tins no dey work for Ghana!

78" Gambia defenders fail to clear di throw ball but Ghana also no fit take advanateg of di ball.

77" Referee now blow whistle for goalkeeper Baboucar to receive treatment.

Di Gambia keeper punch di ball wey im fall for ground dey look for freekick but referee say play on. ghana try to take advantage but dem fail to attack di Gambia defence and di chance don waste.

75" Corner to Ghana.

74" Sulemana don win freekick for Ghana. As tins stand, Gambia go dey happy say dem dey win.

73" Ghana fans for di stadium dey try to sing to give di Black Stars some energy but tins no dey work.

Suleimana Camara dey comot for Sanyang. Ghana also dey carry Augustine Boakye enta to replace Oppong Peprah.

72" Gambia dey put pressure to frustrate di Ghana players and force dem to make mistakes.

70" Ghana try to attack. Sulemana strike again from outside di box; di ball comot for goalkick.

68" Gooooal! Defensive mistake by Gideon Mensa. Colley capitalise and score.

66" Chaaance! Ernest Nuamah shoot from outside di box. Diu ball no threaten di keeper.

66" Di game don bicom tensed. Jerome Opoku dey shout for one Gambia player top say make im get up and play di ball.

64" Ernest Nuamah wey be di best player for Ghana dribble three players and pass di ball to Benjamin Tetteh, di striker no fit control di ball and di chance don waste.

63" Ibou Omar Touray no understand why di ref award Ghana freekick afta im tackle Oppong Peprah.

62" Yellow card for Benjamin Tetteh for foul on Ebrima Adams. Ebrima no happy about dat foul, im face-off wit Tetteh bifor ref intervene wit di booking.

61" Waste! Jonas Adjetey ballon one cross from di far right afta Fatawu carry di ball ad drive inside di Gambia area. Fatawu no happy about dat wasted cross.

60" Freekick to Ghana. Alagie Saine don foul Afena-Gyan.

59" Caleb Yirenkyi don give away di ball again for midfield - Gambia begin counter attack wey no end anywia.

Ebrima Colley don enta to replaceAbdoulie Sanyang for Gambia.

58" Abdoulie Sanyang from di Scorpions team don dey for ground dey hold im thigh. Be like im get hamstring wahala.

57" Sulemana strike one as Ghana try to attack, di ball deflect bifor Baboucar catch am easy.

Ghana win freekick thru Fatawu Issahaku as um dey try to stage counter attack

56" Fatawu Issahaku meet di rebound from di corner, im shot knack di back of im own player inside di Gambia box, wey im player ping one cross too hard and out for goalkick.

55" Corner to Ghana.

54" Ghana defenders make lose for di back, Gambian attacker Sanyang don carry di ball pass thru three players bifor shooting on target. Goalkeeper Asare catch am.

53" Suleimana Camara beat im marker for di far right and plant one cross wey pass everybody and comot for throw-in to Ghana.

52" Dem bin waste di freekick wit dia short routine, dem also waste di corner as Yirenkyi dash di ball to im opponet.

51" Referee don dey warn Abdoulie Sayang bifor di freekick.

Di Black Stars fit score again from dis freekick?

50" Badamosi push Sulemana in front of di Gambia box as im dey prepare to shoot. Referee blow whistle for freekick.

48" Frekick to Ghana. Sulemana win am. Ghana dey try to create some early chance for dis half but so far e no dey work.

47" Sulemana also enta to replace Kwasi Sibo.

Chance! Gambia try to create chance from di Throw-in, di ball end up wit di striker wey head am wide.

46" Gambia win throw-in for di Ghana left hand side. Anoda long throw.

Gambia don pass di ball for di second half.

45" Benjamine Tetteh don enta di pitch bifor di second half go start. Im replace Brandon Thomas-Asante.

Benjamine Tetteh and Ibrahim Sulemana don dey di touchline for Ghana dey wait to enta di game.

Di players don comot for di tunnel for di restart - both coaches no make any changes so far.

Di few fans for di stadium dey hope di Black Stars go return wit fresh energy and create more chances.

First Half

Stay wit us, we go return afta 15 minutes. Ghana take 2-0 lead for di game bifor dem allow Gambia back into di game wit 2 goals in 6 minutes.

HALFTIME!

45+3" Referee don blow whistle for halftime.

45+2" Jonas Adjetey play one cross-cum shot wey almost beat Baboucar but brush off di top of di post bifor e comot.

45+1" Nuamah take one freekick into di area, but one ogbonge clearance by di Gambia defence carry di ball comot for corner.

45+1" Ghana take one corner from di far right of di Gambia area. Di attempt be poor, Gambia recover di ball.

+3 mins

43" Di Black Stars don relax since dem score dia second goal, na so Gambia fight back to score 2 goals in 6 minutes.

Di Black Stars defense comot dia eye for dat long throw wey lead to di Gambia goal.

41" Gooooal. Omar Colley collect di ball, im swivel and shoot into di net.

Di Scorpions dey try for di last few seconds to create chances, dem bin dey create rings for di Ghana area bifor dem put in one cross.

40" Suleimana Camara and Sanyang don try to enta di Ghana area. Dem later lose di ball for throw-in to Ghana.

Muhammed Badamosi wey score di penalty, na di same pesin wey score one of di goals against Somalia last week.

38" Freekick to Ghana. Thomas-Asante fall for ground, Yaya Bojang commit di foul.

37" Gambia tink say dem fit attack and get di equaliser bifor halftime. Dem don win throw-in for di Ghana area. Referee blow whistle for freekick for Ghana.

Muhammed Badamosi score from di spot! 2-1

Referee don give yellow card to Oppong Peprah and Bojang bifor Badamosi go take di penalty.

34" Penalty to Gambia.

Afta di restart, Gambia try to attack immediately, Godeon Mensah foul di attacker.

Gooooal. Felix Afena-Gyan wey bin win dat freekick, shoot straight into di net. 2-0

32" Dangerous freekick!

31" Ghana waste one counter attack as di final pass to Thomas Asante dey too long, im no fit collect am , na so im pass back bifor Afena-Gyan win freekick in front of di Gambia box.

30" Chaaance! Badamosi head di ball down for di Ghana area, Eberima meet am wey im try to shoot on target - Jerome Opoku block im shot.

Di ball now dey for di Gambia camp, dem wan start di build up for dia area.

29" Dem play di corner straight to di side net.

28" Gambia don win corner - dia first corner for dis game.

Di Lyon attacker place di ball well for di goal. Im be di brightest Black Star player so far for dis game.

Gooooal! Ernest Nuamah score di penalty. 1-0

26" Ernest Nuamah go play di penalty.

25" E no dey too clear, dat penalty. Di Gambia captain Omar Colley still dey complain to di referee but di referee already bin make im decision.

Afta di corner, Jerome Opoku try to reach di ball, di Gambian defender contact Jerome wey im fall for ground. Referee immediately point to di spot.

24" Penalty to Ghana!

23" Chaaance! Ghana get anoda chance. One through pass by Nuamah to Afenya-Gyan. Di striker collect di ball wey im try to shot from di tight angle.

21" Chaaance! Ghana create dia first chance for di game, Nuamah dribble wey pass to Fatawu. Di Ipswich Town player ping di cross for di Gambia box, but im teammate no fit connect well, Gambia don clear dia lines.

20" Ibou Omar Touray don throw di ball for di Gambia area to im teammate

19" Captain Gideon Mensah fail to run to pick one return pass for di far right of di Gambia area. disappointing.

18" Oppong Peprah don win freekick as Suleimana Camara push Oppong Peprah for back for di touchline.

17" Yaya Bojang and Colley and Baboucar don dey pass di ball among diaseff for di back bifor di keeper blast di ball inside.

16" Ghana wit 77% of di possession but dem no create anytin. Gambia now get di ball.

15" wit all dia possession, Ghana no get shot for di Gambia area yet afta 15 minutes.

Di Gambian defence don clear dia lines from dat Ernest Nuamah freekick.

14" Afena-Gyan and Caleb Yirenkyi carry di ball dey enta di Gambia area, dem close di spaces so dem pass to Nuamah wey don win freekick.

Jonas Adjetey clear im lines - and win throw-in.

13" Offside flag against di Ghana team.

12" Joseph Ceesay drive for di wings wey im enta di box and di ball fall to im teammate wey try one weak shot. Goalkeeper Asare bin catch am easy.

Di ball now dey for di yard of di Gambians, dem dey string some passes bifor dem enta di Ghana box to try and shoot.

11" Ghana player Oppong Peprah don play one ball into touch, im teammates vex about dat pass.

9" Di Scorpions try to attack, Ghana recover well to collect di ball and start dia own attack.

Tins don calm down - goalkeeper Asare also dey play from di back.

8" Gambia now try to string some passes togeda; dem bin lose am again within seconds.

7" Di Ghana team dey play many long passes for dia strikers - but so far none of dem long balls find dia teammates.

Ghana don dey get plenty possession for di game so far.

6" Suleimana Camara and im teammate foul Oppong Peprah, ref award freekick.

5" Ernest Nuamah no fit collect one pas for di byline for di Gambia far left side.

4" Jonas Adjetey play anoda long ball for Fatawu Issahaku but im no fit meet di ball.

Ebrima Adams don dey collect warning from di ref togeda wit Ernest Nuamah for di center.

3" Di ball dey back to di Black Stars for dia territory, bifor one long ball from defence towards Afena-Gyan comot for goalkick.

2" Referee don warn one Gambia player say dat be im last foul, di next one, im go chop yellow card.

Kwasi Sibo bin lose di ball for midfield; im make lucky say di referee don award am freekick, but dem waste am.

Di Black Stars dey begin to try to pass di ball around to dominate possession for dis early stage.

Ghana bin pass di ball for di almost empty stadium.

1" Referee don blow whistle for game to begin.

Moroccan centre referee Mustapha Kechchaf don lead di teams.

By di end of di 90 minutes, we go see if Ghana or Gambia go win di points.

Ghana dey expected to weat dia all-yellow jersey wey Gambia go wear dia red jersey.

Very soon di players go comot for di tunnel and enta di pitch.

Tins dey set; weather dey clear, some fans also dey di stadium for dis game.

Welcome to di Accra Sports stadium for Ghana wia dis game between Black Stars and di Scorpions of Gambia dey happun.

Ghana dey under pressure to get a result
Wetin we call dis foto, Gambia bin dey enta dis game on di back of dia 2-1 win against Somalia for Group C opening qualifier

Ghana and Gambia coaches don select dia starting XI for dis 2027 Afcon qualifier wey dey happun for di Accra Sports Stadium.

Tins don set for dis game as Ghana make desperate for dia first point for dis qualifiers.

Gambia dey look forward to get another points to boost dia chances afta dia 2-1 win against Somalia.

But di Black Stars no go make am easy.

Dis na di starting lineups for both teams.

Ghana XI: Benjamin Asare (GK), Oppong Peprah, Jonas Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah; Caleb Yirenkyi, Kwasi Sibo, Fatawu Issahaku, Thomas-Asante, Ernest Nuamah, Felix Afena-Gyan

Gambia XI: Baboucarr Gaye (GK), Omar Colley ©, Yaya Bojang, Alagie Saine, Ibou Omar Touray, Joseph Ceesay, Ebrima Adams, Abubakar Barry, Abdoulie Sanyang, Sulemana Camara, Mohammud Badamosi

Buildup

Di Black Stars of Ghana dey jam wit di Scorpions of Gambia for di second game for di 2027 Afcon qualifiers for di Accra Sports stadium.

Ghana bin lose dia first game 2-0 against Ivory Coast wey dey top di table for Group C.

Gambia for di oda hand dey second afta dem also sama Somalia 2-1.

Somalia dey third for di group wey Ghana bin dey sit bottom.

Di Black Stars dey under pressure from fans for di kontri afta dia poor game for Bouake last week.

But di coach Carlos Queiroz believe say im team fit turn tins around despite di fact say six of im key players no dey available sake of injury.

Anoda player Alexander Djiku wey captain di team against Ivory Coast also injure for dat game, im now be dis seventh key player wey no dey available for dis Gambia game.

Earlier, Jordan Ayew, Baba Rahman, Mohammed Kudus, Antoine Semenyo, Prince Kwabena Adu and Nathaniel Adjei all bin pull out.

gambia enters this game with a positive 2-1 win from their first group game
Wetin we call dis foto, Just like Ghana, Gambia also get five of dia key players missing for dis game sake of injury

Despite dis plenty injuries, sabi pipo and fans believe say Ghana still get chance for dat Ivory Coast game bifor, but di team neva click wey dem struggle to create chances.

For di Scorpions of Gambia, dia confidence don dey high ahead of dis game afta dia first group game win against Somalia.

But dem too get dia own injury wahala.

Dia assistant coach Abdou Jammeh tok say di team go miss di absent players pass di way Ghana go miss dia own players.

Musa Barrow, Yakubu Minteh, Abdoulie Manneh and Adama Sidbeh all dey unavailable sake of injury.

Wetin di two coaches tok ahead of di game

Abdou Jammeh tok for di pre-match press conference say im team go feel di absence of di five missing players wey don score 24 goals for di national team for di last months, more than di way Ghana go miss dia own players.

"Our absent players dey more important pass di Ghana Black Stars players wey dey miss dis game."

Im add say im players already dey motivated for dis game.

"We no need to motivate our players, to dey play for di national team na ogbonge tin. Dem already sabi wetin dis game mean. We dey focused well well."

Abdou Jammeh say "we dey hope to get positive result for dis game, our focus no dey on whether Ghana dey good shape or not, or whether di team get positive or negative statistics – we just wan win our game."

For 73-year-old Ghana coach Carlos Queiroz, im depleted team dey ready for di Gambia game.

"We don learn from di Ivory Coast game, na so we prepare well for di attacking department to finish chances wey we go create."

Im add say "we expect di fans and di press to support and trust us to win dis game, even though di team dey face some wahala."

"I dey confident say wit positive football, attacking football, if we perform well, we fit win di game."

ghana lost 2-0 to Ivory Coast
Wetin we call dis foto, Ghanaian fans dey para sake of dia team no dey perform well since di World Cup

Head-to-head and recent form

Ghana bin dey struggle for Afcon qualifiers in recent times, in fact di team fail to qualify for di 2025 Afcon, di first time for 20 years.

But for dia last five games. Ghana bin win only one wey dem lose three and draw one.

Dem also fail to score for three of dia last five game.

In fact, dem dey struggle well well to score goals. For di 2026 World Cup, di Black Stars bin score only two goals in four games.

For Gambia, dem win two of dia last five games, wit three defeats.

Dem also score for four of dia last five games.

Between di two kontris, dem jam each oda eight times for official games bifor dis game.

Ghana don win six of those games, wey Gambia win only one wit one draw.

But dis statistic no go dey important, na afta 90 minutes we go find who go win dis game.

Possible lineup for di two team

Ghana XI: Lawrence Ati-Zigi; Oppong Peprah, Jonas Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah; Caleb Yirenkyi, Kwasi Sibo, Christopher Bonsu-Baah, Augustine Boakye, Thomas-Asante, Ernest Nuamah

Gambia XI: Baboucarr Gaye (GK), Alagie Saine, Yaya Bojang, Omar Colley, Sainey Sanyang, Abubakar Barry, Mahmudu Bajo, Joseph Ceesay, Ebrima Colley, Fadera Alieu, Abdoulie Ceesay

Di game dey happun at 4 PM (5 PM WAT) for di Accra Sports Stadium