Nigeria conclude plan to evacuate more citizens from South Africa, Ghana warn Ghanaians to dey alert ahead of June 30 protest

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria ministry of foreign affairs say dem go evacuate anoda group of citizens from South Africa on Tuesday.
Di minister Bianca Ojukwu say dem dey safeguard Nigerians ahead of di anti-immigrant protests wey go hold for South Africa on 30 June.
According to one statement by di tok-tok pesin for ministry of foreign affairs, Kimiebi Ebienfa, tok say Air Peace plane don depart from Nigeria on Monday and e go retrun to Lagos on Tuesday morning wit more Nigerians wey don show interest in di evacuation.
As di deadline for foreigners make dem come for South Africa dey come close as many anti-immigration groups dey gada to togada to start dia planned protest on 30 June.
Eariler for June, Nigeria govment bin bring back about ova 60 Nigerians from South afta dem bin bring 271 back for May among di ova 1,000 wey don register wit di govment for repatriation.
Local media don report say many immigrants from Malawi, Mozambique, Zimbabwe, Nigeria and Ghana don leave di kontri to return to dia home kontri as dme dey fear for dia lives becos of di xenophobic attack.
Also, Ugandan govment announce say dem go repatriate dia citizens from South Africa, after 746 citizens show dia interest to commot from South Africa and return home safely.
Di ministry tok say president don order anoda set of evacuations for Nigerians wey dey South Africa, mostly women and children wey dey suffer from xenophobic attack, dem go land for Murtala Mohammed International Airport, Lagos afta dem comot from Oliver Tambo International Airport, Johannesburg, SA.
"President Bola Ahmed Tinubu don tok say di evacuations go still continue, even wen deadline don pass, and dem go make sure say no Nigerian wey want come back home go remain behind," di statement tok.
"Oda federal govement agencies like NEMA, NIS, FAAN and NIDCOM go dey for MMI Airport, Lagos to handle documentation, health checks, and profiling for returnees."
"Di safety of our citizens abroad na priority for our Renewed Hope Agenda. We dey committed to protect our citizens outside national borders, and uphold di sovereign bond between our nations and di nationals, especially pipo wey dey face danger."
"To di Returnees, we go say, Welcome back to di Homeland."
Meanwhile, on Monday ahead of di planned protest, South African President Cyril Ramaphosa call on South Africa citizens make dem use dia constitutional right to protest peacefully, as e warn against violence, intimidation and vigilantism becos dem no go tolerate all dis during di planned nationwide demonstrations ova illegal immigration.
Inside di memo wey dey come ahead of di June 30, deadline for foreign black nations, Ramaphosa tok say di growing public agression ova illegal immigration, border management, pressure on public services and criminal networks wey dey exploit di kontri immigration system.
Ramaphosa tok say di govment dey improve border management, take serious steps against undocumented migration, dey enhance asylum and visa processes, and dey tackle corruption wey dey undermine immigration enforcement.
Di president make am clear to di citizens say South Africans get constitutional right for dem make dem protest, but dem must use dat right responsibly as e dey urge protesters make dem show dia view peacefully, lawfully and wit respect for di rights, dignity and safety of oda pipo.
"Dis concerns dey real and e deserve make we hear am," di president tok.
"Wia our systems don fail, we go correct am; Wia corruption don enable illegal immigration, we go hold di pipo wey do am responsible; wia enforcement no dey adequate, e go improve am," Ramaphosa tok.
Di president tok say any criminal acts during di demonstrations go face di law.
"We must reject di act of violence or intimidation say e dey justified on di basis of our grievance, for political reasons, or becos wey some pipo wey dey commit suct act claim say dem provoke dem," e tok.
Ramaphosa also stress say immigration enforcement na responsibility of state institutions wey get authority, no be private individuals.
E welcome assurance from some protest organisers say dem go keep di protests peaceful. "Dem go stay true to dis promise, becos no matta how legitimate, e no go be excuse to shift responsibility for violent act," Ramaphosa tok.









