Heatwave grip UK, France, Spain and oda parts of Europe as France raise health alert to highest level

    • Author, Paul Kirby
    • Role, Europe digital editor
    • Author, Laura Gozzi
    • Author, Bethany Bell
    • Role, In Leipzig
  • Published
  • Read am in 6 mins

Heatwave wey dey hold western Europe don cause plenty record-breaking high temperatures.

France dey experience dia hottest day eva, UK don see record-breaking heat for June, and Spain don reach dia highest daily average temperature since 1950.

Millions of pipo dey suffer under serious hot temperature, wey reach almost 41°C for Paris, and don make authorities declare red heat alert for plenty parts of Europe.

France national temperature indicator say di average of day and night temperatures across dozens of locations hit 30C on Wednesday, di hottest day since records begin for 1947.

More dan half di kontri still dey under red heat alert, and tens of thousands of homes for di west dey witout power.

Temperatures for Germany fit hit 40C for some western and south-western areas on Thursday, and across di kontri on Friday. One extreme weather warning now dey in place for most part of Czech Republic.

For France, Prime Minister Sébastien Lecornu announce say dem don raise di health alert level go di highest, to boost hospital staffing and to protect di vulnerable.

Health Minister Stéphanie Rist tok say now dem dey see deaths among young pipo wey dey linked to di extreme temperatures, and for elderly pipo too.

UN climate change chief Simon Stiell don tok say "di serious heatwave wey dey worry Europe get clear sign of climate crisis inside am", and e say make pipo "do fast U-turn and begin use renewable energy, protect forest and make dem strengthen how dem fit handle climate wahala".

Afta France record dia hottest day on Wednesday for di second day in a row, new records continue to dey break.

Météo-France tok say di average minimum temperature reach 22C on Wednesday night. Nantes see 27.2C for di north-west.

Paris mayor Emmanuel Grégoire say death rate don dey increase for Paris, as temperature don dey veri high for some days now.

"Make we no tink say notin fit reach us," e tell French TV. "I dey tink especially about young pipo… Around 7:30 yesterday evening… I see like 100 pipo dey jog for road. To tok true, e no dey responsible."

"E dey fine to take some days off from exercising," e add.

Meanwhile, dem don see di deadi bodi of one three-year-old pikin wey die inside motor for Paris region, few days after two small children die inside dia family car for di southern town of Carpentras.

For di north-western city of Rennes, di head of Accident and Emergency department Professor Louis Soulas link di deaths of five or six pipo for dia homes for di region to extreme temperatures.

Emergency services bin go check on dem afta dem no gree pick dia calls during welfare calls, Soulas tok: "No be pipo wey too old like dat; na pipo wey dey di age of 60 and above."

Rennes bin record 40.6C on Monday, but by Tuesday di temperature bin rise to 41C. Di previous record bin date back to 2022.

Di region intensive care units don "full," e warn. "Our hands dey veri full."

Sébastien Lecornu tok say France Orsan health emergency plan now dey move go level three, so dat di health system go fit "withstand di strain ova time and protect di most vulnerable".

Three nuclear plants for France don go offline sake of di heat.

Some western regions for France now dey ready for huge thunderstorms from Thursday afternoon onwards.

Gusts of up to 110km/h (68mph) dey expected for France Atlantic coast, and dem don cancel di first day of di Garorock festival for di Lot-et-Garonne region - wia temperatures fit reach 42C.

Climate change dey increase temperatures around di world - but particularly for Europe.

Even though temperature for Spain go reach like 38–39°C for some areas on Thursday, weather experts tok say cooler Atlantic air dey come. Dem give dis informate afta dem record veri high June temperatures dis week, wey include 45.1°C for southern town of Andújar on Monday.

For Germany, overnight temperatures for di southwestern town of Bad Bergzabern no fall below 26.2C on Wednesday night, e be di same as one national heat dem record for 2019.

Germany DWD weather service say most part of di kontri dey experience "heat stress" and DWD meteorologist Oliver Reuter say e dey "quite likely" say dis heatwave go later make history.

Luxembourg record dia highest June temperature of 38.3C for Wormeldingen on Wednesday. Authorities don extend di red alert level for "extreme thermal stress" go Saturday night.

For Germany, dem don cancel di Hamburg half marathon wey suppose hold on Sunday and national train operator Deutsche Bahn dey offer free ticket cancellations for anybodi wey no wish to travel again sake of di extreme heat. Czech Railways don tell dia passengers say make dem postpone dia trips, if e no dey too compulsory.

MeteoSuisse put most part of northern and southern Switzerland on maximum weather alert as dem warn say e fit cause "significant drought situation".

Temperatures across di Czech Republic bin enta 30s on Thursday and di ČHMÚ Hydrometeorological Institute tok say di heat go increaseon Friday as temperatures go climb reach 40C for weekend.

Weekend temperatures fit also hit 40C for Austrian capital Vienna.

UK Met Office don extend dia red extreme temperatures warning until Friday evening, for some parts of London and south-eastern England.

For Italy, Florence Uffizi museum don stop to sell tickets until 28 June, and na only dose wey don book bifor dem go allow enta di museum.

Management say di air conditioning system fit no dey enough for di plenty visitors wey go wan come plus di extreme temperatures, wey reach 32C for inside di museum on Wednesday.

Italians don dey experience high temperatures since di start of dis week - but di peak of di heat dey expected for Monday, wen 40C dey expected for various northern regions.

Night-time temperatures for dose areas fit no drop below 29C.