'My son na easy-going pesin, no be troublemaker' - Papa of DG of alleged fake agency PFIPC

Wia dis foto come from, BBC/Prince Adeyemi Adeniyi/Instagram
Di papa of Adeyemi Adeniyi, di Director-General of di alleged fake federal govment agency, Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), don cry out say e no know why police break into im house afta di allegations against im son.
Local media report say police arrest Adetunji for im home for Ogbomoso area of Oyo State.
Di papa follow BBC tok for im house on Tuesday, wia e narrate im ordeal for di hands of di police and wetin im know about im son accusation for Abuja.
E tok say dem question am bifor dem carry am go police station.
"Dem tear all di barbed wires wey we mount on di wall wey surround di house and break di fence and door of my house," Adeniyi tok.
Di papa show how police damage di entrance to di Adeniyi family compound and wen e confront dem, dem say dem be security pipo.
"I ask dem wia dem dey come from, and dem say dem be security officials," di papa add.
Wetin happun be say Prince Adeniyi Adeyemi dey run one agency called di 'Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), but presidency say dem no get dat kain agency and no be dem approve am.
Di tori of Prince Adeniyi Adeyemi don gain national appeal as President Bola Tinubu even order investigation into di matter as e also concern office of di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila.
'My son work dey for Abuja, no be troublemaker' - Adetunji Adeniyi

Adetunji tell BBC say afta di police officers forcefully enta im family residence dem begin search di entire house, including im laundry room and kitchen.
Adeniyi tok say dem leave im im residence around 1:00 p.m. but wen e reach about 2pm dem come back and take away di phones wey dey for di house and leave again.
"Wen e don reach about 11:00 a.m. di next morning, dem come again. I dey worry, I just dey say, 'Wetin be dis again, my God?' Dem wan kill me?"
Wen dem ask am wetin im son dey do for as work, Adetunji tok say di police officers bin ask am dis same question and wetin im know be say Adeyemi tok say im dey work for Abuja.
"My son na easy-going pesin, no be troublemaker. All I know be say im tok say im dey work for Abuja. Na easy-going pesin since e dey small," e tok
"I dey very sad as I dey hear all dis reports. I dey really confused by all dis. I go dey lie if I tok say I no dey confused."
Adetunji also tell BBC say im pikin bin dey home wit am for Ogbomoso from Tuesday, June 30 to Wednesday, July 1.
"E come home about eight days ago, and leave di next day, e tok say im dey go back to Abuja," Adetunji tok.
"Dem (police) ask me how I no know wia my son dey live. I no tok say I no know wia e dey live. E dey live for Abuja. But wen e dey go work, I no fit go tell am say make e no go work?"
Di papa tok say police ask am plenti kwesions but na di ones wey e sabi im tell dem.
Wetin happun bifor?

Wia dis foto come from, Prince Adeniyi Adeyemi/Instagram
Last week Wednesday, di tok-tok pesin to di President of Nigeria, Bayo Onanuga, claim say di appointment of Adeniyi Adeyemi as di Director-General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council na fake as di president no make such appoinment or create di office. .
Adeniyi Adeyemi, bim im claims say na im be di Director-General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council.
However, statement from Femi Gbajabiamila, di president Chief of Staff, tok say di Nigeria govment no get any office like dat and say President Bola Tinubu no eva give any appointment to Adeyemi.
Onanuga inside im statement on Wednesday, accuse Adeyemi say e use fake documents wit forged signatures and seals, to dey claim leadership appointment for office wey no dey in existence.
E also tok say police don chook eye for di mata and dem establish say di agency wey Adeyemi claim say e be di DG na fake, and say di man bin forge im appointment letter plus oda documents wey police recova from im house and office.
However, Adeyemi bin deny di allegation wey both Onanuga and Gbajabiamila dey put on im head.
For Statement wey e release on 26 June 2026, e claim say e get documents to show say true-true Presido Tinubu give am appointment.
Adeyemi tok say di Presidential Foreign Intervention Promotion Council wia e be Director General get account wit di Central Bank of Nigeria (CBN), and di govment bin allocate money to dem for di 2026 budget.
After dis claims, di Nigeria president Bola Tinubu don order Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) make dem conduct investigation into di matta.
Di president direct di commission make dem conclude dia investigation and submit report within 30 days.









