'No come Ghana for now' - Ghanaian govment advise South Africa President Ramaphosa

Ramaphosa looking at di camera wit Ghana and South Africa flag for di back

Wia dis foto come from, PHILL MAGAKOE/AFP via Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Ghana govment under President John Mahama don advise South African President Cyril Ramaphosa to cancel im planned visit for now sake of di current xenophobic tensions.

Di Ghanaian govment say di best tin na make Ramaphosa no show for Ghana now sake of security concerns.

President Ramaphosa bin plan state visit to Ghana for di first week of August, wey some analysts believe say na part of efforts to reduce tensions between di two kontris.

Di Ghana govment get concern say mass protests fit happun for Ghana if di South African president visit di kontri.

Dis na becos of di plenty tori on how some Ghanaians allegedly kpai for South Africa during di anti-immigration protest.

During di June 30 protest, Ghana authorities don condemn di killing one of dia citizen Bahiru Isak, for Khayelitsha for Cape Town, South Africa.

Ghana Foreign Affairs Ministry allege dem kpai di 40-year-old citizen during anti-immigration protests on June 30.

South African authorities describe di claim as "false information by Ghana about irregular migration for di kontri".

Di Govment of Ghana say di fatal shooting happun during di anti-immigration protests on 30 June, 2026, but South African authorities say e no happun.

For dia response, South African authorities deny di accuse, dem say na different victim, 35-year-old Kwabena Boagen, wey also be Ghanaian, but na different crime scene wey no dey related to di anti-immigration protests.

Ghana foreign ministry say di report shock dem well-well, especially afta many African kontris don demand protection for dia citizens by South African authorities bifor, during and afta di 30 June nationwide anti-immigration protests.

Also, reports of looting, attacks and harassment for some areas dey vex dis African kontris - especially Ghana, Nigeria and Malawi.

Na part of dis tension make Ghana say make di South African president no come Ghana for im visit yet.

''We send dem communication wey indicate say e go dey best to stop di visit in view of di present climate around xenophobia.'' Felix Kwakye Ofosu, govment tok tok pesin tell BBC.

Diplomatic tensions between di two kontris don increase afta some South Africa anti-migrant group confront Emmanuel Asamoah, wey dey live for South Africa, say make e ''go fix im kontri''.

Ghana don repatriate ova 900 of dia citizens from South Africa, and di last batch of ova 900 odas dey expected to come back home for di coming weeks.

Oda African kontris, including Nigeria, don also repatriate dia nationals from South Africa.

Ghana govment say dose wey dey responsible for dis latest killing gatz face di law.

South African police say di pesin wey die no dey connected to xenophobic attack during di 30 June protests.

Police tell di BBC say di death na from one robbery incident wey happun on Monday, 29 June, a day bifor di 30 June anti-immigration protests.

Di two kontris also get disagreements ova di legal status of Ghanaians wey dey live for South Africa.

Authorities for Ghana claim say most of dia nationals get legal documentation for South Africa, but South African authorities also say na lie.

Even though di two knotris no provide evidence to support dia claims.

For May, Ghana petition African Union ova issues of xenophobic attacks for South Africa.

Ghana say make AU ct and launch fact-finding mission to address attacks on foreigners, wey dey against di African Continental Free Trade Area agreement.

Analysts say South Africa fit dey isolated on di continent if urgent measures no show to address di anti-immigration protests and diplomatic tensions.

Xenophobia no be new tin for South Africa, wit foreigners chopping blame for unemployment and crime.

Authorities assure say dem dey address immigration issues, but many want make South Africa appreciate historical support instead of to dey target foreigners.