Why Nigeria dey transfer ova 100 prisoners from Ethiopia? Wat next for dem

Published
Read am in 4 mins

Nigeria sign deal wit Ethiopia say dem go send back ova 100 prisoners wey dem sentence for different offences.

Di Nigerian govment say di transfer of dis prisoners wey dey serve dia prison term for Ethiopia take some time but dem dey go through di process to bring dem back home.

Nigeria Minister of Foreign Affairs Bianca Odumegwu-Ojukwu say na ova 100 Nigerian Prisoners currently dey suffer for Ethiopia prisons.

She mention two prisons for Ethiopia wia dem go carry di prisoners back to Nigeria.

"Your kontri no go leave you, your President know say you dey here". Dis na wetin Nigeria foreign affairs tok wen she visit some of di prisoners for Ethiopia.

According to Bianca, dis prisoners go return to Nigeria 'to serve di remainder of dia prison terms, sake of di Prisoner Transfer Agreement.

Di minister say di prisoners dey happy say dem go comot from Ethiopia prison. For di video wey she post for her X page, e show wia di prisoners gada and dey show dia happiness.

Howeva, Nigerians dey reason how plenti numbers of Nigerians end up for Ethiopian prisons.

Di prisoners go dey exchanged from two prisons wey be di Kaliti Prison and Aba Samuel Prison.

According to report, Kaliti Prison na maximum-security correction center for Ethiopia. Na wia dem dey keep political prisoners, and plenti of foreign inmates inclduing di hundreds of Nigerians wey dey dia.

Aba Samuel prison na anoda major correctional facility for Ethiopia wey dey house prisoners wey dey serve dia term.

Howeva, data from World Prison Brief by di Institute for Crime & Justice Policy Research for London say Ethiopia get about 110,000 prison population for 2020, including dose wey dey on trial.

Di Minister of Foreign Affairs of Ethiopia and Nigeria, see di agreement as good cooperation and humanitarian justice between di two nations.

Na Nigeria Minister of Justice, Lateef Fagbemi, and Ethiopia Justice Minister, Hanna Arayaselassie, sign di documents for di transfer of pesin wey dem don sentence.

Although, plenti tins still dey wey neva clear about dis transfer of prisoners from Ethiopia to Nigeria.

Why Nigeria and Ethiopia agree to transfer prisoners

Nigerian govment say di 'Transfer of Sentenced Persons Agreement' na bilateral agreement between di two nations.

One big kwesion na why di exchange of prisoners dey come at dis time and why e dey necessari for Nigeria and Ethiopia.

According to Nigeria foreign affairs minister, she say dis transfer of prisoners na part of di govment concern about di welfare and protection of Nigerian citizens wey dey live abroad.

She add say di agreement dey rooted for "di principles of humanity, justice and cooperation between our two nations."

Meanwhile, she say four Nigerian Prisoners don die for prison under di time wey dem begin di negotiations and judicial process for di agreement.

"We no fit afford to lose any more precious lives. We are determined to bring home di living. Several odas dey critically ill and need better care and medical assistance," Nigeria minister of foreign affairs say.

On di oda hand, Ethiopia federal prison commission say di agreement na sake of cooperation within di two kontris.

According to di prison commissioner, General Yenus Mulu, di agreement to relocate dis prisoners wey dey guilty of dia offences.

"Agreement dey reached to strengthen di cooperation for di field of justice and to relocate 94 Nigerian law prisoners wey dem find guilty by di federal prison commission to dia home kontri."

While Nigeria say na ova 100 Nigeria prisoners go return, Ethiopia say na 94 prisoners.

Nigerian govment make am clear say di prisoners go return to Nigeria to complete dia prison term.

BBC Pidgin don reach out to Ethiopia ministry of justice of more details on di case of di transfer of prisoners to Nigeria including wetin be di offences wey dem dey charged for.