Peter Obi, Rabiu Kwankwaso join NDC ahead of 2027 general elections

Read am in 3 mins

Di former govnor of Anambra State Peter Obi and di ex-govnor of Kano State Rabiu Kwankwaso don join di Nigeria Democratic Congress (NDC).

Dis dey come afta di Labour Party presidential candidate for di 2023 general elections bin confam say e dey comot for di African Democratic Congress (ADC).

Obi give di informate for im X page on Sunday 3 May, wia e tok say im decision na sake of di endless court cases, internal battles, suspicion, and division for di party.

"Make I assure all say I no dey desperate to be President, Vice President, or Senate President. I dey desperate to see society wey fit console mama wey her pikin don dey kidnapped or killed while going to school or work.

"I dey desperate to see Nigeria wia pipo no go live for IDP camps but for dia homes. I dey desperate for a kontri wia Nigerian citizens no go go bed hungry, not knowing wia dia next meal go come from," e tok.

Oda tins Obi tok for im statement

For im statement on Sunday, Obi say many pipo no truly understand di silent pains some of dem dey carry daily wey include di private struggles, emotional burdens, and quiet battles wey dem dey face while trying to survive and serve sincerely for difficult circumstances.

"We now live for environment wey don become increasingly toxic, wia di system wey suppose protect and create opportunities for decent living often dey work against di pipo—a society wia intimidation, insecurity, endless scrutiny, and discouragement don become normal," e tok.

"More painful na wen some of dose you associate wit, believing you go find understanding and solidarity among dem, become part of di pressure you dey face. Some wey publicly identify wit you privately distance demselves or join in unfair criticism."

According to Obi, we live for society wia pipo dey mistake humility for weakness, and dey see respect as lack of courage, and dey treat compassion as foolishness.

E say inside dis system, treating pipo equally dey questioned "simply becos you refuse to worship status, tribe, class, or power".

"Personally, I neva look down on anyone except to uplift dem. I neva use privilege, position, or resources to oppress odas, intimidate di weak, or make pipo feel small. To me, leadership don always be about service, sacrifice, and helping odas rise.

"Make I state clearly: my decision to leave di ADC no be becos our highly respected Chairman, Senator David Mark, treat me badly, or becos my leader and elder brother, Alhaji Atiku Abubakar, or any oda respected leaders do anytin personally wrong to me. I go continue to respect dem," e tok.

Obi accuse di Nigerian state and im agents say na dem bin create unnecessary crises and hostility within di Labour Party wey bin force am to leave, and add say dem now appear to dey find dia way into di ADC, wit endless court cases, internal battles, suspicion, and division.

"Yet, despite evritin, I remain resolute. I firmly believe say Nigeria fit still become kontri wit competent leadership based on justice, compassion, and equal opportunity for all," di former govnor add.