APC state assembly primaries: Desmond Elliot withdraw, Barakat win, oda tins you need sabi

Wia dis foto come from, Desmond Elliot/Barakat Odunuga-Bakare/Facebook
Di All Progressives Congress (APC), on Wednesday, hold dia primary elections for aspirants wey wan contest for seats into di various State House of Assembly across di kontri.
As e be say APC dey control 32 out of di 36 states for Nigeria, dis contest for state legislative seats don dey even more competitive as politicians dey hustle to put diasef into position of power.
Hia na wetin hapun for some of di key states:
Lagos State: Desmond Elliot withdraw, Brakat win
Desmond Elliot declare im withdrawal from di APC primaries afta Barakat Odunuga-Bakare win di party primaries.
"In all zones dem dey intimidate and stop us. I wan officially announce my withdrawal from dis particular race. Na my ward be dis, if you go outside you go see my pipo, dem no allow dem enta" e tok.
Di party declare Barakat Odunuga-Bakare winner of di APC Surulere Constituency 1 primaries for di Lagos State Assembly on Wednesday.
Barakat win di all di wards with 11,385 votes during di APC primaries elections while Desmond lose to im opponent wit 270 votes across all wards.
Bifor di primaries election, Femi Gbajabiamila, Chief of Staff for Nigeria allege say Desmond bin wan make im lose im job afta di president tell am say Desmond dey involve in di impeachment of Mudashiru Obasa wey be di speaker of di Lagos State house of assembly.
Desmond tell BBC News Pidgin say im no dey involve in di matta as e bin travel go South-Africa dat time and wen im come back im tink say di order na from di above.
Desmond apologise and beg for forgiveness from Gbajabiamila say as papa as e relay dia relationship to di one between pikin and im papa.
Rivers State: APC drop Fubara loyalists before primaries
Di APC state assembly primaries for River State go get interest from almost evribodi for Nigeria, sake of di public gbas-gbos betwin di current govnor of di state Siminialyi Fubara and im predecessor and current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike.
Both men bifor na political godson and godfather but dem since don quarrel sotey even President Bola Tinubu no fit settle dem.
Dis quarrel don tear di state assembly apart wit majority of di members supporting Wike while just a few dey on di side of Fubara.
Although all di state lawmakers plus di govnor later decamp from di Peoples Democratic Party (PDP) to join di ruling APC, tori be say oga Wike still dey run tins for di state even wen e be say e still remain for di PDP.
On Tuesday, di APC release list of more dan 60 aspirants wey no pass dia screening exercise for di state assembly aspirants, and tori be say many of di names dia na pipo wey dey loyal to Fubara.
Similar tin bin also happun for di screening exercise for di Senate and House of Representatives aspirants, wia some supposed Fubara supporters no make am, including one former deputy govnor and sitting senator, Ipalibo Banigo-Harry.
Di Rivers APC state assembly primaries na definitely one to watch.
Kano State: Abba Yusuf major test
Kano State na anoda interesting state for di APC state assembly primaries, sake of di drama surrounding how di current govnor Abba Yusuf take decamp from im former party, di New Nigeria Peoples Party (NNPP) to di ruling APC.
Yusuf bin defeat di APC candidate during di 2023 govnorship election and na NNPP members bin also win majority of di state assembly seats.
Now wey di govnor don join di APC, togeda wit many of im loyalists for di state assembly, e go dey interesting to watch how dis new pipo go contest for tickets wit dia former opponents wey bin don dey for di APC ova di years.
Some analysts say di sitting members wey get di support of di govnor fit get small advantage, especially sake of di directive wey President Bola Tinubu bin give say state govnors must get say for who go hold di ticket of di party ahead of di 2027 general elections.
Imo State: Uzodinma mathematics
Di state assembly primaries of di APC go also dey veri interesting for Imo State, especially sake of di situation wey di sitting govnor Hope Uzodinma dey inside.
Oga Uzodinma don already get ticket to run for Senate for 2027, even though im second tenure as govnor go end by January of 2028, almost seven months afta di inauguration of di 11th Senate by June of 2027.
E neva clear di mathematics wey oga Uzodinma dey plan to do, but some analysts dey suggest say e fit resign, put im deputy govnor in office as acting govnor, den go to di Senate to resume im new position, bicos di law no allow one pesin to be govnor and still be senator for di same time.
But whatever be di plan of di govnor, e go need to get di members of di state assembly for im side so dat di plan go fit succeed.
If dis primary election go like di one of di Senate and House of Reps for Imo State, den e mean say na di aspirants wey oga Uzodinma don endorse go get di ticket.










